Why Your Pee/Urine Fit Dey Dark and Wetin You Suppose Know
Read in: English | Pidgin English
π©Ί Medically reviewed by licensed physicians with over 10 years of clinical experience
π Quick Breakdown
Normal urine suppose dey light yellow in color.
If e begin change color, like:
• dark yellow
• brown
• or even red
e mean say, your body dey try tell you something.
π§ How e dey take start?
Sometimes you go notice say:
• your pees dey darker than usual
• e dey smell stronger
• or d amount reduce
Most times:
• na dehydration dey cause am
ππΎ If you no drink enough water, your urine go dey concentrated.
π§ Why e dey happen?
• 1. dehydration
→ because d body dey try save water, d urine go come dey darker
• 2. liver problem
→ wen bile substances from d liver enter d urine
• 3. kidney or urine infection
→ blood or waste product fit d change d color of d urine
ππΎ Heavy exercise sef fit cause muscle breakdown wey fit change d urine color.
π§ How you go know say e serious?
• eyes or skin turn yellow
→ e fit be liver problem
• blood appear for urine
→ dis one fit mean kidney or urinary wahala
• severe muscle pain with dark urine
→ dis one na muscle breakdown emergency o.
ππΎ All these signs need quick medical check up.
π§ Wetin you fit do by yourself or for house
• drink enough water
→ urine color fit improve efter some time
• try monitor d urine change
→ see if d urine color change to normal efter some hours
• reduce alcohol intake
→ to protect your liver
ππΎ If urine no return to normal, abeg go check am early.
π§ Real life example
Mamma bola notice say her urine dey dark after long day for work
as she dey think about am, she con dey wonder why her urine get strong smell
she con remember say she no drink enough water that day.
After she begin dey:
• drink more water
• rest well
within short time:
• d urine color return to normal
• d strong smell disappear
ππΎ Simple dehydration fit cause dark urine.
But for another case:
If d dark urine come with yellow eyes or you dey feel too weak:
• Dat one fit be mean serious problem!
π§π©Ί When you suppose go hospital π¨
• yellow eyes or skin
• blood for urine
• severe muscle pain or weakness
ππΎ Remember say e fit mean liver, kidney, or even muscle breakdown emergency.
π’ Final reassurance
Dark urine dey common and e often dey linked to dehydration.
But continous changes or warning signs deserve proper medical check up.
ππΎIf person understand him body signals and e dey check early, e fit help prevent bigger problems later o.
π Reference
For full medical references, see English version of this article.
β οΈ Disclaimer
This article na for education only.
E no replace advice from doctor.
If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional.
πRelated Health Topics
• Dehydration
• Chronic Kidney Disease
• Swollen Legs
• Urinary Tract Infection
• Muscle Injury
ππΎ If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version