Diabetes: When sugar level for blood too high

Read in: English | Pidgin English

Published on April 25, 2026 at 3:39β€―PM

🩺 Medically reviewed by the Health Decoded Guide Editorial Team · Last reviewed: July 2026


πŸ” Quick Breakdown

Diabetes na condition wey make sugar level for blood too high. E fit happen slowly and many people no go know early.

πŸ‘‰πŸ½ Early control fit prevent serious problems later.


🟧 Wetin dey happen?

Body dey use insulin control sugar.

• insulin dey help d sugar enter cells
• if insulin no work well
• sugar go remain for blood dey accumulate

πŸ‘‰πŸ½ That na d main problem.


🟧 Wetin be d different types of Diabetes

Diabetes Type 1
→ body no produce insulin

Diabetes Type 2
→ insulin no work well (insulin resistance)

Gestational Diabetes
→ high blood sugar wey start during pregnancy

πŸ‘‰πŸ½ Na Diabetes type 2 common pass.


🟧 Why e dey happen?

• poor diet
→ too much sugar and processed food

• no exercise
→ body no fit use sugar well

• genetics
→ family history (e dey fit run for family)

πŸ‘‰πŸ½ Many factors fit combine to cause am.


🟧 How you go know say u get am?

If Symptoms show early: 

• you dey thirsty always
• you dey urinate often
• you dey always feel tired

πŸ‘‰πŸ½ These na d common early signs abeg no ignore dem o.


🟧 Wetin you fit do

• eat balanced diet
→ to control sugar

• exercise regularly
→ to improve insulin usage

• take medicine if needed
→ doctor go guide you

πŸ‘‰πŸ½ Consistency dey important.


🟧 Real life example

Cynthia dey go work everyday, but she notice say…

• she dey tired even after sleep
• she dey thirsty everytime
• she dey urinate often

For office, people dey talk:

• “Why you dey yawn like this?”
• “You dey go toilet too much o…”

At first, she think say na stress…

But as days dey go :

• her energy drop even more
• she begin lose small weight

πŸ‘‰πŸ½ Body dey give warning signs

She go hospital go check…

After test:
• blood sugar level high

πŸ‘‰πŸ½ Na so dem diagnose diabetes

πŸ‘‰πŸ½ Lesson:
Small small symptoms fit mean something—no ignore am


🟧🩺 When you suppose rush go hospital 🚨

confusion
breathing wahala
weakness worsen
dehydration

πŸ‘‰πŸ½ na emergency signs!


🟒 Final reassurance

Diabetes serious—but dey manageable.

πŸ‘‰πŸ½ With proper care, person fit live healthy life.


πŸ“š Reference

For full medical references, see English version of this article.


⚠️ Disclaimer

This article na for education only. E no replace doctor advice.

If you get symptoms or concerns, abeg see healthcare professional.


πŸ”—Related Health Topics

Diabetes prevention
Blood Sugar monitoring
High Blood Pressure
Chronic Kidney Disease
Healthy Diet Basics
Healthy Lifestyle and Weight management

πŸ‘‰πŸ½ If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version