Urine wahala: when toilet habit begin change
Read in: English | Pidgin English
π‘ Wetin dey happen?
LUTS na group of symptoms wey affect how you dey store urine or how you dey pass am. The full name na Lower Urinary Tract Symptoms. E mean say:
• you fit dey go toilet plenty times
• or urine no go come out well, e fit be like small small at a time or even small small drops sef
π Na common issue, especially as person dey grow older.
π‘ Why e dey happen?
• bladder overactive (d bladder dey fire too much)
→ bladder dey contract too early
• blockage or narrowing for somewhere for the urinary tract
→ something dey disturb urine flow
• infection
→ bladder dey irritated
π Urination na teamwork—if one part misbehave, symptoms go show.
π‘ How you go know say e no dey normal?
• you dey wake up many times for night to go urinate
→ E dey disturb sleep
• urine stream dey weak or dey stop-start
→ D flow no smooth
• sudden strong feeling to go toilet wey hard to control
→ sometimes sef with leakage
π If e begin affect daily life, make you go check am.
π‘ Wetin you fit do by yourself or for house
• reduce caffeine (coke, cola, coffee) and late-night drinks
→ e go help control the frequency
• bladder training (Physiotherapist/doctor or even nurse fit show hoe to do am, e help delay urination small)
→ E go improve control
• observe your pattern
→ to helps doctor understand your symptom faster
π Small habit changes fit reduce symptoms.
π‘ When you gats/suppose go hospital π¨
• you no fit urinate
• u see blood for your urine
• u get severe pain or fever
π These signs need urgent attention—no delay.
π‘ Final reassurance
LUTS no be one disease—many causes dey, and most get solution.
π Once you understand the cause, treatment go clearer.
π Reference
For full medical references, see English version of this article.
β οΈ Disclaimer
This article na for education only.
E no replace advice from doctor.
If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional.
πRelated Health Topics
• Prostate enlargement
• Urinary Tract Infection
• Blood in urine
π If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version