Pikin get Fever First, Then Rash: E Fit Be Roseola

Read in: English | Pidgin English


πŸ” Quick Breakdown

If your pikin get high fever for some days,
then suddenly rash show when fever don go down—e fit be roseola.

πŸ‘‰πŸ½ Many times, pikin go begin feel better when rash show


🟧 Wetin dey happen?

• na viral infection

• fever go come first

• rash go show later

πŸ‘‰πŸ½ Na this pattern be d main clue

πŸ”₯ D pikin go even feel better when d rash show

 


🟧 Dem dey call am “3 days fever”

Dem dey call am “3 days fever” because the pikin go get high fever for about 3–5 days.

• Fever fit high well well, sometimes e reach 39–40°C

• after like 3-5 days, d rash go con show for their body

• d rashes dey show for chest and back mostly but even for d face too

• d pikin fit still dey lively, dey play around

But na the fever be the main thing wey dey show first

 


🟧 Why d rash dey come after the fever:

• As the pikin get the virus, d body go start to dey fight for d infection,

• d body go increase the temperature to fight am 

• and den d fever drop suddenly as d body immune system don take control

Na dat time d rash go con show for skin (mostly chest and back)

πŸŸ‘πŸ‘‰πŸ½ So the rash no mean say d sickness dey worse—instead na sign say d body dey recover

 


🟧 When e no be problem

• pikin dey play again

• fever don go

πŸ‘‰πŸ½ This na d normal pattern


πŸ”Ά When you suppose worry 🚨

• fever too high more 40°C and e stay pass 2-3 days

• pikin weak well well

• convulsion, e get seizure

πŸ‘‰πŸ½ No delay to check am o!


🟒 Final reassurance

Roseola na common viral infection and e dey mostly mild

πŸ‘‰πŸ½ Rash na sign say pikin dey recover

 


πŸ“š Reference

πŸ”ΆFor full medical references, check English version


⚠️ Disclaimer

This article na for education only.
E no replace doctor advice.

If your pikin get serious symptoms, high fever wey no dey go, or you no sure wetin dey happen, abeg see healthcare professional quickly.


πŸ”— Related Health Topics

Dry Skin
Skin rash for pikin
Skin infection
Hand, foot and mouth disease

πŸ‘‰πŸ½ Keep learning to understand your pikin body better