When pikin dey vomit and e get loose stool —wetin e mean
Read in: English | Pidgin English
π Quick Breakdown
Gastroenteritis na wen pikin dey vomit and e get diarrhea from infection.
Most times e mild—but water loss (dehydration) na the main risk.
ππ½ Wetin dey important na to make sure d pikin drink fluid/water.
π§ Wetin dey happen?
This condition dey affect d belle (stomach) and d intestine.
• pikin go dey vomit
• and d stool go dey loose and frequent
ππ½ E dey common for small children.
π§ Why e dey happen?
• 1. virus
→ na most common cause
• 2. bacteria
→ from bad food or water
• 3. poor hygiene
→ infection dey spread easily from dirty environment
ππ½ Children dey pick infection easily from environment.
π§ How you go know say e don pass normal?
• pikin no dey pass urine
→ dehydration sign!
• mouth dry
→ fluid don reduce
• pikin dey too weak
→ serious sign!!!
ππ½ These signs mean say d pikin body need help fast.
π§ Wetin you fit do by yourself or for house
• give fluid/water small small
→ e go prevent dehydration
• continue light feeding/give d pikin food even though na small small e go chop
→ support energy
• make d pikin rest, no dey send am too much message
→ help recovery
ππ½ Oral rehydration solution dey very useful( you fit buy am for pharmacy or make am for house).
π§ π©ΊWhen you suppose rush go hospital π¨
• no urine or very dry mouth
• d vomiting no dey stop
• you see blood for stool
ππ½ These signs serious—go hospital immediately!.
π§ Final reassurance
Most cases go resolve within few days.
ππ½ As long as you prevent dehydration, pikin go recover well.
π Reference
For full medical references, see English version of this article.
β οΈ Disclaimer
This article na for education only.
E no replace advice from doctor.
If your pikin dey sick, abeg see healthcare professional.
πRelated Health Topics
• Vomiting Pikin
• Diarrhea Pikin
• Nausea
• Stomach pain
• Fever for pikin
ππ½ If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version