Chickenpox vs Measles: How You Go Know the Difference
Read in: English | Pidgin
π Quick Summary
Chickenpox dey cause itchy water water rash, while measles dey cause flat red rashes with cough and red eyes.
1οΈβ£ Introduction
Chickenpox and measles na two viral infections wey fit cause fever and rash.
Many people dey confuse dem because dem fit look alike for the begining.
But dem get clear differences.
2οΈβ£ How e take happen
Chickenpox
• na virus wey dey affect mainly the skin
• and e dey spread through contact with the small droplets from the skin
Measles
• na virus wey dey spread through air
• e first affect breathing system, then later e go spread go the whole body
π Na why measles symptoms dey dey more serious sometimes.
3οΈβ£ Symptoms before rash
Chickenpox
• small fever
• tiredness
• no appetite
Measles
• high fever
• cough
• runny nose
• red eyes
π Measles get more body symptoms before rash start.
4οΈβ£ Rash explanation
This na the main way to sabi the difference:
πΉ Chickenpox rash
• dey start like small red spots for body
• later e go turn to water blisters, asper the rash go get water inside am
• later the water go dry and na dey patch wey dem dey call scab go con remain
π all the different stages dey usually show together
π e dey itch well well
πΉ Measles rash
• be like flat red rash
• e dey start from the face
• and den e go con spread go the rest of the body
π no blisters or water rash like chicken pox o
π The rash dey start together asper them go come at once for the body
5οΈβ£ Main differences
Rash type
• Chickenpox → blisters (water water rashes)
• Measles → flat rash
Itching
• Chickenpox → E dey scratch body well well
• Measles → E nor dey scrtach to much
How e dey spread
• Chickenpox →e dey scatter
• Measles → e dey start from face go down the rest of the body
Other symptoms
• Chickenpox → skin symptoms pass
• Measles → cough, red eyes, body symptoms
6οΈβ£ When e dangerous
π¨ Go hospital immediately if:
• breathing hard
• high fever no reduce
• confusion
• seizures
• dehydration
β οΈ Measles fit cause serious lung infection.
β οΈ Chickenpox fit serious for adults or weak immunity.
7οΈβ£ Prevention / management
πΉ Prevention
• vaccine
• avoid infected person
πΉ Treatment
• rest π
• drink water π§
• control fever
π Doctor go guide treatment.
8οΈβ£ Diagnosis
Doctor go use:
• symptoms
• rash pattern
π Test fit needed.
9οΈβ£ Important message
Even though dem fit look alike at first, chickenpox and measles different.
Knowing the difference fit help you act early and avoid problem.
π FAQ
πΉ Which worse?
Measles usually more serious.
πΉ Dem fit look alike?
Yes for beginning.
πΉ I must isolate?
Yes.
πΉ Adult fit get am?
Yes.
πΉ Vaccine dey?
Yes.
Related Health Topics
πΉ Chickenpox
πΉ Measles
πΉ Fever
πΉ Skin rash for pikin
Medical Disclaimer
This article na for education only.
E no replace doctor advice.
Go hospital if symptoms worsen.