When toilet no dey come easy—wetin your body dey try tell you
Read in: English | Pidgin English
π‘ Wetin dey happen for your bowel?
Constipation na when person dey struggle to pass stool or e no dey come often.
• that is, d stool go hard and dry
• you go need push more than usual
π E fit happen to anybody—and most times e get simple explanation.
π‘ Why e dey happen sef?
• low fiber food
→ if food wey u dey chop no get enough fiber, the stool no go soft
• no enough water
→ if person no drink enough water, the body go remove more water from stool for the intestine, and this one fo make the stool hard
• waiting for too long to go toilet
→ if you no go toilet when body give that signal, the stool go stay longer and e go con dry
π Na combination of food, water, and habit dey control bowel movement.
π‘ How you go know say e no dey normal?
• you dey strain too much
→ if passing stool dey too stressful, like u dey sweat too much but nothing dey comot.
• u dey pass stool less than usual,like you dey go once per week
→ especially if e change from your normal pattern
• you feel say you no finish
→ like u still dey feel full after u don toilet
π E no always serious—but if e persist, make you check am o!
π‘ Wetin you fit do by yourself or for house
• chop more fiber
→ fiber dey plenty for fruits, vegetables, and whole grains and e go help make the stool soft
• drink enough water
→ e go dey make the stool soft and easy to pass
• move your body
→ exercise help bowel movement wella
π Small consistent habits dey solve most constipation cases.
π‘ When you gats go hospital π¨
• if u see blood for stool
• you get severe stomach pain
• constipation wey no dey improve
π These signs need proper medical check—no ignore am.
π‘ Final reassurance
Constipation common—and most times e dey manageable.
π Once you adjust small habits, your body go respond well.
π Reference
For full medical references, see English version of this article.
β οΈ Disclaimer
This article na for education only.
E no replace advice from doctor.
If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional.
πRelated Health Topics
• Abdominal pain
• Diarrhea
• Digestive problems
π If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version