Skin wey dey always dry and itchy; E fit be Eczema

Read in: English | Pidgin English

Published on April 11, 2026 at 11:39β€―AM

🩺 Medically reviewed by the Health Decoded Guide Editorial Team · Last reviewed: July 2026


πŸ” Quick Breakdown

If your skin dey always dry, itch, and irritate you from time to time,e fit be eczema.

Eczema na skin conditon wey dey affect d skin barrier, dey make am dey sensitive

πŸ‘‰πŸ½ E no dey spread from person to person. E fit dey come, dey go—but you fit control am


🟧 Wetin dey happen?

• eczema na condition wey make skin dry and sensitive
• d skin barrier no too strong
• small things go fit irritate d skin easily

πŸ‘‰πŸ½ Na why the skin dey itch and react fast


🟧 Why e dey happen

• d skin no dey hold moisture well
• d body dey react too much to small irritation
• sometimes e dey run for family

πŸ”₯ No be infection—and e no dey spread


🟧 Who e dey affect / How common e be

• babies and small pikin
• people wey get allergy or asthma
• people with sensitive skin

πŸ‘‰πŸ½ Very common—especially for children


🟧 When e no be problem

• small dry patches
• itching no too much
• no extra infection ontop

πŸ‘‰πŸ½ Many people dey manage am without stress


πŸ”Ά When you suppose take am serious 🚨

• itching dey disturb sleep
• skin very red or painful
• skin begin leak small small water, skin dry well well con be like crust, or e swell
• e no dey improve at all

πŸ‘‰πŸ½ If e dey affect your daily life, no ignore am


🟧 How e dey look / Signs

• dry, rough skin
• itching (sometimes na strong itching)
• red or dark patches
• small rash or bumps
• d skin sef go fit dey become thick if person scratch am every time

πŸ‘‰πŸ½ Scratching fit make am worse o!


🟧 Wetin you fit do

πŸ’§ 1. Moisturize well

• use thick cream everyday

πŸ‘‰πŸ½ This na the main treatment, gbam!


🚿 2. Treat your skin gently

• avoid too hot water
• no rub skin hard

πŸ‘‰πŸ½ Gentle care important


🚫 3. Avoid things wey dey trigger am

• strong soap
• perfume
• rough clothes

πŸ‘‰πŸ½ Know wetin dey make your own worse


πŸ§‘πŸΎ‍βš•οΈ 4. If e stubborn

• doctor fit give medicated cream

πŸ‘‰πŸ½ Follow proper advice


🩺 When to see doctor🚨

• eczema strong  or plenty for your skin
• e don dey disturb your sleep
• your skin dey infected, like small pus start to commot, e start to swell and e dey pain you
• Your treatment no dey work

πŸ‘‰πŸ½ No need to struggle alone, go make doctor check am


🟧 Real life example

One evening after bath time, Mama Chioma notice say both of her children skin dey more dry.

For Udo, the skin for him legs and hands just look dry and so think say na because of the weather.
She rub moisturiser for am every day, and after one week the dryness almost disappear.

But Ekaete no improve.

Instead, she begin scratch her skin all through d night. D skin behind her knees and inside her elbows become red, 
and the scratching make am get small wound sef.

Mama Chioma begin worry.

She think say maybe Ada don catch skin infection because the rash no dey go, while Tobi own don clear.

When she carry Ada go hospital, d doctor explain say no be ordinary dry skin and no be skin infection.

Na eczema.

The doctor advise regular moisturiser, avoiding things wey fit trigger the eczema, and medicated cream to use whenever d eczema flare up.

After some weeks, Ada skin improve well, and she begin sleep better because d itching reduce.

πŸ‘‰πŸ½ Dry skin and eczema fit look alike at first, but eczema usually dey itch more, come back often, and sometimes need medical treatment to control am.


🟒 Final reassurance

Eczema dey common and e dey manageable

E fit not disappear completely, as per e dey con dey go.  But e fit calm down well with correct treatment

πŸ”₯ D goal na to control am—not to get perfect skin o


πŸ“š Reference

For full medical references, check English version


⚠️ Disclaimer

This article na for education only. E no replace doctor advice

If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional


πŸ”— Related Health Topics

Dry skin
Keratosis pilaris
Allergies
Simple Skin care
Common Skin Rash pikin
Skin Infection

βœ¨πŸ‘‰πŸ½ If you want, you fit read d English version