Liver infection (hepatitis)—wetin you need know
Read in: English | Pidgin English
π Quick Breakdown
Hepatitis na when d liver irritate con dey swell up (inflammation na the medical name for am), most times because of infection.
E fit dey mild or serious depending on the type and how long e stay for person body.
ππ½ Your liver important well well—so any problem there need attention.
π§ Wetin dey happen?
Liver na organ wey help clean your blood and process food wey person chop.
• when e dey inflamed (dey irritated)
• e no go work well like before
ππ½ e go affect many other body function.
π§ Wetin fit cause am?
• 1. virus: D main virus wey fit cause am na hepatitis A, B, and C)
→ infection go enter liver
• 2. alcohol or drugs
→ dis one go damage d liver cells
• 3. toxins or medicine
→ dis ne dey stress the liver to much
ππ½ Different causes—but d result na liver inflammation.
π§ How you fit know say person get am?
• yellow eye or skin
→ jaundice (na d medical name)
• dark urine, d urine go get dark colour like dirty water
→ liver no dey process waste well
• person go always dey tired
→ body dey struggle,
ππ½ These signs show say liver don dey involved and e dey weak.
π§ Wetin you fit do by yourself or for house
• avoid alcohol
→ to protect your iver
• eat balanced diet
→ e go support recovery
• rest well
→ to help healing
ππ½ But proper diagnosis still dey very important o!!
π§ When you gats go hospital π¨
• confusion or drowsiness
• severe pain for your belle
• person dey vomit every time
• You notice yellow eye or skin
ππ½ These signs serious—no delay.
π’ Final reassurance
Some hepatitis dey mild and fit resolve by e self.
ππ½ But early check and care/treatment go protect your liver.
π Reference
For full medical references, see English version of this article.
β οΈ Disclaimer
This article na for education only.
E no replace advice from doctor.
If you get symptoms or concern, abeg see healthcare professional.
πRelated Health Topics
• Jaundice
• Fatigue
• Fever
• Anemia
• Liver disease
ππ½ If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version