Why You Dey Feel Weak and Tired? E Fit Be Low Iron Problem.
Read in: English | Pidgin English
π Quick Breakdown
If you dey feel tired, weak, or low on energy,
sometimes na becos d iron level for your body dey low.
ππ½ Iron dey help carry oxygen for blood—so your body fit work well
π§ Wetin dey happen for your body?
• iron na mineral wey body need
• e help form blood wey carry oxygen
• if iron low, d body no go get enough oxygen
ππ½ Na why person go begin feel tire or weak
π§ Why e dey happen
• you no dey get enough iron from food (unbalanced diet)
• blood loss (like heavy period)
• d body no dey absorb iron from the intestine well
• body need more iron (like for pregnancy)
ππ½ Iron deficiency no just happen once
Iron level for body dey reduce small small over time until symptoms begin show.
π§ Who e dey affect / How common e be
• some women wey dey menstrate especially if na heavy flow/bleeding
• people wey get heavy bleeding
• people wey no dey chop balanced food
• pregnant women
ππ½ This thing common well especially for women
π§ When e no be problem
• iron levels no too low
• no symptoms yet
• diet fit correct am
ππ½ No be every case serious
πΆ When you suppose take am serious π¨
• iron very dey low
• you dey feel tired every day
• dizziness or weakness dey
ππ½ If e dey affect your daily life, abeg go check am
π§ Signs to watch
• weakness
• pale skin (see d picture on topβπ½)
π§ Wetin you fit do
• improve your diet, include iron rich food/vegetable like lever, meat, ugu, better leaf, beans etc
• talk to doctor
• take supplements if needed ( u fit ask for pharmacy)
ππ½ Treatment usually depend on wetin cause am
π‘ When to see doctor
• tiredness no dey go
• you confirm low iron
• symptoms dey worse
π’ Final reassurance
Iron deficiency dey common and treatable
ππ½ With correct care, body fit recover well
π Reference
πΆFor full medical references, check English version
β οΈ Disclaimer
This article na for education only.
E no replace doctor advice.
If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional
π Related Health Topics
• Fatigue
• Anemia
• Healthy Diet Basics
• Test results explained
β¨ππ½ If you want full explanation, read English version