Why You Dey Feel Weak and Tired?  E Fit Be Low Iron Problem.

Read in: English | Pidgin English

Published on February 19, 2026 at 11:52β€―PM

🩺 Medically reviewed by the Health Decoded Guide Editorial Team ·
Last reviewed: July 2026


πŸ” Quick Breakdown

If you dey feel tired, weak, or low on energy,
sometimes na becos d iron level for your body dey low.

πŸ‘‰πŸ½ Iron dey help carry oxygen for blood—so your body fit work well


🟧 Wetin dey happen for your body?

• iron na mineral wey body need 
• e help form blood wey carry oxygen
• if iron low, d body no go get enough oxygen

πŸ‘‰πŸ½ Na why person go begin feel tire or weak


🟧 Why e dey happen

• you no dey get enough iron from food (unbalanced diet)
• blood loss (like heavy period)
• d body no dey absorb iron from the intestine well
• body need more iron (like for pregnancy)

πŸ‘‰πŸ½ Iron deficiency no just happen once

Iron level for body dey reduce small small over time until symptoms begin show.


🟧 Who e dey affect / How common e be

• some women wey dey menstrate especially if na heavy flow/bleeding
• people wey get heavy bleeding
• people wey no dey chop balanced food
• pregnant women

πŸ‘‰πŸ½ This thing common well especially for women


🟧 When e no be problem

• iron  levels no too low
• no symptoms yet
• diet fit correct am

πŸ‘‰πŸ½ No be every case serious


πŸ”Ά When you suppose take am serious 🚨

• iron very dey low
• you dey feel tired every day
• dizziness or weakness dey

πŸ‘‰πŸ½ If e dey affect your daily life, abeg go check am


🟧 Signs to watch

tiredness
weakness
dizziness 
breathing wahala
• pale skin (see d picture on top☝🏽)


🟧 Wetin you fit do

• improve your diet, include iron rich food/vegetable like lever, meat, ugu, better leaf, beans etc
• talk to healthcare worker
• take supplements if needed ( u fit ask for pharmacy)

πŸ‘‰πŸ½ Treatment usually depend on wetin cause am


🚨 When to see doctor 🩺

• tiredness no dey go
• you confirm low iron
• symptoms dey worse


🟒 Final reassurance

Iron deficiency dey common and treatable

πŸ‘‰πŸ½ With correct care, body fit recover well


πŸ“š Reference

πŸ”ΆFor full medical references, check English version


⚠️ Disclaimer

This article na for education only.
E no replace doctor advice.
If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional


πŸ”— Related Health Topics

Fatigue
Anemia
Healthy Diet Basics
Test results explained

βœ¨πŸ‘‰πŸ½ If you want full explanation, read English version