Why Some Women Dey Feel Pelvic or Lower Belle Pain During Pregnancy
Read in: English | Pidgin English
π©Ί Medically reviewed by licensed physicians with over 10 years of clinical experience
π Quick Breakdown
Pelvic pain during pregnancy common because your body dey change to support d growing baby.
Some pain dey mild and harmless.
But if you get:
• severe pain
• bleeding
• fever
e fit mean emergency.
ππΎ D type and location of d pain dey important to help sabi wetin dey cause d pain.
π§ How e dey take start?
As pregnancy dey grow:
• d womb dey expand gradually
• d ligaments dey stretch
• and d pelvic joints go dey loosen
Dis one fit cause:
• pulling pain
• pressure
• heaviness
especially during movement.
ππΎ Hormones also dey affect muscles and joints during pregnancy.
π§ Common causes
• Round ligament pain
→ Round ligaments na strong bands wey help hold d womb in place.
As the baby and womb dey grow, these ligaments dey stretch.
Dis stretching fit cause sudden sharp or pulling pain,
especially when d pregnant woman stand up fast fast, cough, laugh, roll for bed, or even change position.
• Pelvic joint stress
→ as we mention before during pregnancy,
hormones dey help loosen the joints and ligaments around the pelvis to prepare your body for childbirth.
This fit make your hips, lower back, or pelvis ache,
especially after walking, climbing stairs, or standing for long time.
• Pressure from the growing baby
→ As the baby grow bigger,
e dey put more weight and pressure on the muscles, joints, bladder, and pelvis.
This fit make you feel heaviness, discomfort, or dull pain for your lower belle and pelvic area.
Small aches and mild discomfort fit happen as pregnancy dey progress,
ππΎbut severe pain, heavy bleeding, fever, or pain wey no improve suppose make person go hospital.
π§ Other causes wey fit happen
• urinary infection
• constipation
• ovarian cyst problems
ππΎ Not every pelvic pain during pregnancy na “normal pregnancy pain.”
π§ Wetin you fit do by yourself or for house
• rest and avoid sudden movement
→ reduce strain on pelvis
• use pillow support during sleep
→ improve comfort
• attend antenatal visits regularly
→ help monitor pregnancy health
ππΎ Gentle movement fit sometimes help reduce stiffness and discomfort.
π§π©Ί When you suppose go hospital π¨
• severe pelvic pain
• bleeding or fluid leakage
• dizziness or
• fever
ππΎ These symptoms need urgent pregnancy evaluation.
π§ Real life example
As her pregnancy reach middle stage, Esther begin feel:
• sharp pain for lower belle anytime she stand up quickly
At first:
- she panic because she think say something fit don happen to the baby.
- She quickly go hospital make doctor check am.
After examination:
- doctor explain say na round ligament pain as the womb and the ligaments wey hold am dey stretch because d baby dey grow.
Doctor advise her to:
- rest when the pain come
- avoid sudden movements
- change position gently
As the pregnancy continue:
- the pain gradually improve, and both Esther and the baby remain healthy.
Before she go home, doctor tell her say:
"You do the right thing to come check. We always prefer make we check you and find out say everything dey okay than make you stay house when something serious fit dey happen."
ππΎ Pregnancy pain fit dey scary, especially for first-time mothers. If something no feel right, no hesitate to go for check-up. Better to hear "everything is okay" than to ignore a serious problem.
π’ Final reassurance
Mild pelvic pain fit happen during pregnancy because your body dey adjust as the baby dey grow.
But severe pain or any unusual symptom no be something to ignore.
Women, we know say una strong well well. But abeg if your body dey tell you say something no dey right, abeg no endure am for house. Go hospital or see healthcare worker make dem check you.
ππΎ Early medical attention fit help protect both you d mama and d baby.
π Reference
For full medical references, see English version of this article.
β οΈ Disclaimer
This article na for education only.
E no replace medical advice from qualified healthcare professional.
If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional.
πRelated Health Topics
• Pregnancy Symptoms
• Spotting Between Periods
• Urinary Tract Infection
• Ovarian Torsion
• Ectopic Pregnancy
ππΎ If you still get questions or Prefer full medical detail? Read English version