Peripheral vascular disease: When blood no dey flow well for legs

Read in: English | Pidgin English

Published on April 29, 2026 at 10:29β€―PM

🩺 Medically reviewed by the Health Decoded Guide Editorial Team· Last reviewed: July 2026


πŸ” Quick Breakdown

Peripheral vascular disease na when blood vessels for body (especially legs) get problem.
E dey reduce blood flow and fit cause pain.

πŸ‘‰πŸ½ E common for people wey get diabetes or dey smoke.


🟧 Wetin dey happen?

• fat go dey build up for blood vessels
• d blood vessels go con dey narrow
• blood no go flow well

πŸ‘‰πŸ½ This reduce oxygen to legs.


🟧 Why e dey happen?

• smoking
→ e dey damage blood vessels and reduce healthy blood flow

• diabetes
→ d high sugar fit damage blood vessels over time

• high blood pressure (BP)
→ e go put extra pressure for blood vessels wey go come make them weak

• high cholesterol
→ fit cause fat to build inside d blood vessels and e go block d blood flow

πŸ‘‰πŸ½ These factors fit damage blood vessels and increase risk of stroke


🟧 D 3 major types of dis vascular problem

• artery problem [Peripheral Artery Disease (PAD)]
→ blood no dey reach some body parts well

• vein problem
→ blood go dey gather for d veins instead im to dey flow back

• lymph fluid problem
→ body fluid no dey drain well, so swelling fit happen

πŸ‘‰πŸ½ Different vascular problems fit affect blood flow and body in different ways


🟧 How person fit notice d artery problem (PAD)?

Some people go notice say:

• leg dey pain dem when dem dey waka
• but after small rest, d pain go reduce
• d leg fit dey cold or feel numb sometimes

πŸ‘‰πŸ½ Na because blood no dey reach the leg well well


🟧 How d vein problem fit look?

For some people:

• leg fit swell up
• veins fit show for skin (varicose veins)
• d leg go dey feel heavy, especially for evening time

πŸ‘‰πŸ½ E happen when blood dey gather for one place instead of to dey flow back


🟧 Wat about d lymph fluid swelling problem?

Sometimes body fluid no dey drain properly:

• d arm or leg fit swell
• the place fit feel tight or heavy

πŸ‘‰πŸ½ This kind swelling fit last long


🟧 Other signs

• wounds no go dey heal well
• skin colour change especially for d legs
• weak pulse

πŸ‘‰πŸ½ Circulation don reduce for dis stage.


🟧 Wetin you fit do by yourself

• stop smoking
→ improve blood flow

• walk regularly
→ strengthen circulation

• take medication
→ doctor go guide

πŸ‘‰πŸ½ Lifestyle change dey very important.


🟧 Real life example

Person dey walk…

After small distance:
• d back of leg (calf) start to dey pain am

Rest:
• pain stop

πŸ‘‰πŸ½ Na PAD sign.


πŸ”ΆπŸ©Ί When you gats go hospital 🚨

• pain even when resting
• wound no heal
• toe change colour

πŸ‘‰πŸ½ Serious stage—need urgent care.


🟒 Final reassurance

PVD serious—but manageable.

πŸ‘‰πŸ½ Early care fit prevent complications.


πŸ“š Reference

For full medical references, see English version of this article.


⚠️ Disclaimer

This article na for education only.
E no replace doctor advice.
If you get symptoms or concern, abeg see healthcare professional.


πŸ”—Related Health Topics

Coronary artery disease
Diabetes
Heart Disease Prevention
High Blood Pressure 
Stroke prevention

πŸ‘‰πŸ½ If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version