When Pikin No Gree Chop Food: Wetin Parents Suppose Know

Picky eating HDG image

Read in: English | Pidgin English

Published on May 9, 2026 at 11:05β€―AM

🩺 Medically reviewed by the Health Decoded Guide Editorial Team · Last reviewed: July 2026


πŸ” Quick Breakdown

Many children dey go through period where dem:
• dey reject certain foods
• prefer only few types of food
• complain about texture or even sef d smell of d food

Dis na common childhood issue for many families.


🟧 How e dey take start?

Sometimes toddler wey chop well before fit suddenly:
• begin refuse vegetables
• only want specific foods
• push plate away during meals

Some children fit also:
• dey fear to try new foods
• no like soft, crunchy, or mixed textures of d food

πŸ‘‰πŸΎ Appetite naturally dey change during childhood growth stages.


🟧 Why e dey happen?

•1.  toddler independence
→ children begin choose wetin dem want or no want

•2.  sensory sensitivity
→ texture, smell, or appearance fit bother some children

•3.  stressful feeding environment
→ pressure and forcing fit make am hard for d pikin to chop

πŸ‘‰πŸΎ Sometimes constipation, illness, or pain for d mouth fit also reduce appetite for short period of time.


🟧 How you go know say e serious?

• pikin don dey lose weight
→ body no dey get enough nutrients to grow well
→ dis one fit affect d pikin energy, immunity, and normal development
→ e mean say d pikin fit dey weak and e go dey fall sick often

• pikin get problem to swallow or e choke wen e dey chop
→ feeding or medical problem fit involved

• d pikin only dey chop very few foods for long time
→ d pikin need professional check up

πŸ‘‰πŸΎ No be every picky eater get serious problem, but growth and nutrition still dey important to monitor.


🟧 Wetin you fit do by yourself or for house

• try not to force or shout too much wen d pikin dey chop (even if e no easy)
→ d pressure fit make am worse

• try get patient and continue to dey give different foods calmly
→ e fit help the help d pikin accept d food las las even if na small small

• e good to keep regular food routines
→ too many snacks/junk food fit reduce hunger for d main food later

πŸ‘‰πŸΎ Praise d pikin small efforts because many times e dey work better than punishment or bribing.


🟧 Real life example

Little Zayad suddenly stop to dey eat many different foods after d age of two.

D parents notice say:
• he only want bread and indomie
• he no dey touch d vegetables and some fruit wey dem give am

At first:

• Dem punish am, even beat am small join
• but Zayad still no gree chop.
• d family con panic say maybe na serious dey wrong

But after pediatric assessment:
• doctors explain say na picky eating and e dey common for small pikin

With calm routines and repeated food exposure (with professional help):
• Zayad begin dey try more foods small small over time again

πŸ‘‰πŸΎ Many picky eating phases improve slowly with patience and consistency.


🟧🩺 When you suppose go hospital 🚨

• Pikin dey lose weight
severe dehydration or weakness
• swallowing problem or pikin dey choke many times wen e dey chop

πŸ‘‰πŸΎ Serious feeding problems fit sometimes affect nutrition and development.


🟒 Final reassurance

Picky eating fit dey very stressful for parents, but many children gradually outgrow dis phase.

E good to create calm positive foodtime experience for d pikin as e go help to build healthier eating habits as time dey go.

πŸ‘‰πŸΎ Patience and consistency usually dey help more than pressure and force o!.


πŸ“š Reference

For full medical references, see English version of this article.


⚠️ Disclaimer

This article na for education only. E no replace advice from doctor.

If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional.


πŸ”—Related Health Topics

Nutrition and Child Development
Constipation
Poor Growth for Pikin
Anxiety in Children
Healthy Diet Basics

Explore more on children Health

πŸ‘‰πŸΎ If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version