Sleep Problems: Why Sleep No Dey Come and Wetin E Mean

Read in: English | Pidgin English

Published on March 26, 2026 at 1:04β€―AM

🩺 Medically reviewed by the Health Decoded Guide Editorial Team · Last reviewed: July 2026


πŸ” Quick Breakdown

Sleep problem no just mean say you no sleep—it fit mean say your body and brain no get d quality rest wey dem need.

Most times, na stress, poor sleep habits or another sleep condition dey behind am.

πŸ‘‰πŸ½ If your night no stable, your day go suffer.


🟧 Wetin dey happen?

Sleep suppose dey happen naturally.

But sometimes, d brain and body no fit work together d way dem suppose to.

You fit:

• lie down but sleep no come
• wake up many times for night
• wake early and no fit sleep again
• sleep plenty hours but still dey wake up tired

πŸ‘‰πŸ½ Modern life don make many people's brain stay for "awake mode" even when d body don tire.


🟧 Why e dey happen?

stress and overthinking
→ your brain no fit calm down

anxiety or depression
→ fit make am hard to fall asleep, stay asleep, or sleep well

• phone and screen light
→ your body no release enough sleep hormone (melatonin)

• irregular sleep time
→ e dey confuse your body clock

• caffeine, alcohol or some medicines
→ fit make am difficult to sleep

• sleep apnoea (common but many people no know say dem get am)
→ breathing fit stop small small many times while you dey sleep
→ because of dat, your sleep no deep even if you sleep many hours
→ Loud snoring, waking tired every morning or another person noticing say your breathing dey stop while you sleep fit be signs.

Many times, more than one thing fit dey cause sleep problems.

Anxiety and depression fit affect your sleep, and poor sleep fit make dem worse too.'

πŸ‘‰πŸ½ Your body like routine. Once routine scatter, sleep fit scatter too.


🟧 How you go know say e don become problem?

• you dey wake tired almost every day
• you dey wake many times every night
• you no fit concentrate during the day
• your mood dey change easily
• you dey get scary sleep experiences

→ your body no get enough quality sleep

πŸ‘‰πŸ½ If poor sleep begin affect work, school or everyday life, e don pass normal level.


🟧 Different sleep experiences wey people dey get

Some sleep experiences fit disturb your sleep and make you wake tired. 

• bad dreams (nightmares)
→ frightening/scary dreams wey fit wake you suddenly

• night terrors (common for children)
→ pikin fit shout, cry or look frightened without fully waking up

• sleep paralysis
→ you wake but your body refuse move for a short time

πŸ‘‰πŸ½ Some people talk say e feel like person dey room or something press their chest, but na recognized sleep condition—no be spiritual attack.


🟧 Real life example

Ada dey sleep around 2 am almost every night because she dey always dey phone.
Instead make she sleep, she begin scroll TikTok...

One video become ten.
One hour become two.

Before she know am...

Na 2 am.

She dey wake up by 6 am every morning to go work.
After first she no feel anything but later she con dey tire for mornings.

She think say she just need coffee.

Weeks pass...

She begin dey forget small small things.
She dey quick vex.
She no get too much energy again like before.

Meanwhile, she begin crave sugary snacks almost every afternoon.

One day, she realise say even though she dey tired every day...
She still no fit sleep well at night.

So she decide to go see healthcare professional.


πŸ”„ The Sleep Cycle

Poor sleep no dey usually stop by itself.

Instead, e fit become one cycle.

• body no rest
→ brain no reset

• energy go drop
→ stress go increase

• stress increase
→ sleep become harder

• poor sleep affect hunger hormones
→ you fit crave sugary or junk food

• some people go gain weight

• some people fit lose weight

πŸ‘‰πŸ½ Poor sleep fit even increase the risk of

πŸ”Ά The simple truth:

Bad sleep → bad mood → bad habits → worse sleep.

πŸ‘‰πŸ½ If you no break d cycle, d cycle fit continue break you.


🟧 Wetin you fit do by yourself or for house

• sleep and wake up around the same time every day
• reduce phone or screen use at least 30–60 minutes before bed
• avoid caffeine late during d day
• create quiet, dark and comfortable place to sleep
manage stress with relaxation, prayer, meditation or deep breathing

πŸ‘‰πŸ½ Even small changes for your bedtime routine fit improve your sleep over time.


🟧 When you suppose go hospital 🚨

• sleep problem don last several weeks
• you dey wake tired every single day
• you dey snore loudly or person notice say your breathing dey stop while you sleep
• scary sleep episodes dey happen often
• poor sleep dey affect work, school or everyday life

πŸ‘‰πŸ½ Doctor fit help find d cause and recommend d right treatment.


🟒 Final reassurance

Sleep problem common for today’s life—but e fixable.

πŸ‘‰πŸ½ Once you understand your habits, you fit take back control of your sleep.


πŸ“š Reference

For full medical references, see English version of this article.


⚠️ Disclaimer

This article na for education only. E no replace doctor advice. 

If sleep problem continue, abeg see healthcare professional.


πŸ”—Related Health Topics

Stress and burnout
Anxiety
Depression
Fatigue
Sleep and Recovery

πŸ‘‰πŸ½ If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version