Bacteria Show for Your Urine But You No Get Symptoms: Wetin E Mean?

Read in: English | Pidgin English


πŸ” Quick Breakdown

If bacteria show for your urine but you no get symptoms,
e no always mean say your body dey sick — the bacteria fit just dey there but e no cause any wahala

πŸ‘‰πŸ½ Our body get some bacteria normally, and many of them no dey cause problem

✨ Many times, you no need any treatment!

 


🟧 Wetin dey happen for your body?

Asymptomatic bacteriuria as doctors dey call am na when:

• bacteria show for urine test (e.g.  e.coli)
• but you no feel anything
• you no get pain, no burning feeling, and no urinary wahala atall

πŸ‘‰πŸ½ Meaning say; bacteria dey, but e no dey cause infection

 


🟧 Why e dey happen

• Our body get "normal" bacteria wey no dey cause problem (e.g. Lactobacillus or E. faecalis)

• some bacteria sef like Escherichia coli dey normally for d intestine, and dem dey help with:

  • digestion (food break down)
  • vitamin production (like vitamin K)
  • protect against other harmful bacteria

πŸ‘‰πŸ½ For that place, e normal and even dey helpful

• but if dis same bacteria enter urine, e fit show for test

• d body immune system fit control small bacteria so e no go turn to infection

• d sample/test kit sef fit pick some bacteria from skin during testing and e go show for the result

πŸ‘‰πŸ½ D bacteria by himself sometimes no be d problem— but na d place where dem dey and how many dem be na im be d matter!

 


🟧 Who e dey affect / How common e be

• some healthy women fit get am

• older adults dey see am more

• people wey get catheter dey get am well well

πŸ‘‰πŸ½ This thing common pass wetin people think o!

 


🟧 When e no be problem

• if you no get any symptoms

• if your body dey control the bacteria

• you no get any sign of infection like fever

πŸ‘‰πŸ½ Sometimes, body and bacteria fit stay together in harmony (balance)

 


πŸ”Ά When you suppose take am serious 🚨

• if symptoms start (e.g. stomach pain, burning feeling wen u dey urinate, u dey go urinate plenty times)

• you get fever or u dey feel sick

• if you carry belle, (pregnant women)

πŸ‘‰πŸ½ If symptoms show, na different situation be dat one o!

 


🟧 Wetin you fit do

• no panic

• no rush go take antibiotics

• follow up with doctor if u no dey sure

πŸ‘‰πŸ½ In many cases, you no need any treatment 

 


🟑 When to see doctor

• if symptoms start

• you dey pregnant

• you dey feel unwell like say u sick

• you get fever

• your test result confuse you

 


🟒 Final reassurance

This condition common and many times no be serious matter, e dey harmless

πŸ‘‰πŸ½ Your body fit handle small bacteria without problem

πŸ‘‰πŸ½ No need for unnecessary antibiotics if you no get symptoms o!

 


πŸ“š Reference

πŸ”ΆFor full medical references, check English version.


⚠️ Disclaimer

This article na for education only.
E no replace doctor advice.
If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional.

 


πŸ”— Related Health Topics

Sexually Transmitted infection (STI)
Urinary tract infection (UTI)
Blood in urine
• Test results explained

βœ¨πŸ‘‰πŸ½ If you want full explanation, read English version.