When your belle dey feel too full—understanding bloating

Read in: English | Pidgin English

🟑 Wetin dey happen?

Bloating na when your stomach go feel full, tight, or even look bigger.

• sometimes na just feeling
• sometimes belle fit actually swell

πŸ‘‰ E common well well—especially after eating.


🟑 Wetin dey cause am?

• gas build-up
→ food wey we dey chop fit produce gas for inside our intestine

• slow digestion
→ sometimes the food no dey move fast enough for inside the belle and intestine

• sensitive gut
→ or sometimes d body dey react more to normal digestion

πŸ‘‰ las las na how your gut dey process the food wey u chop dey cause that feeling.


🟑 How you go know say e no dey normal?

• bloating dey happen too often
→ no be only sometimes 

• e dey come with pain
→ the discomfort too strong

• bloating with weight loss or appetite change
→ something deeper fit dey happen

πŸ‘‰ If pattern change, better to check am.


🟑 Wetin you fit do by yourself or for house

• chop slowly
→ e go reduce the amount of air wey person dey swallow with the food

• reduce trigger foods
→ like beans or fizzy drinks (eg: coke, fanta, pepsi etc)

• stay active
→ movement dey help digestion, take like 10-20 mins waka like 20-30 mins efter u don chop finish

πŸ‘‰ Small adjustments fit reduce bloating well well.


🟑 When you gats go hospital 🚨

• bloating no dey go efter some time
• u get severe pain for belle too
• u don dey loss weight

πŸ‘‰ These signs need proper medical check.


🟑 Final reassurance

Bloating dey common—and most times e no serious.

πŸ‘‰ Once you understand your body, you fit manage am easier.


πŸ“š Reference

For full medical references, see English version of this article.


⚠️ Disclaimer

This article na for education only.
E no replace advice from doctor.
If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional.


πŸ”—Related Health Topics

• IBS
Constipation
Abdominal pain 
Heartburn
Food Poisoning

πŸ‘‰ If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version