Chronic Lung Disease: Why Breathing problem no dey go and e dey worse as time dey go
Read in: English | Pidgin English
π Quick Breakdown
Chronic lung disease na long-term problem wey affect how you dey breathe.
E no dey come just once—e dey develop small small over time.
ππ½ Early care fit slow am down and make life easier.
π§ Wetin dey happen?
Your lungs suppose allow air enter and oxygen pass well.
• but with this condition
• d airway fit narrow or lung fit weak
ππ½ So air no go flow freely again.
π§ Why e dey happen?
• smoking
→ main cause
• dust or pollution
→ damage lungs gradually
• repeated infections
→ weaken lung over time
ππ½ Damage no happen one day—na gradual.
πΆTypes
Chronic lung disease no be one thing — dem dey group am based on how e affect breathing.
• Obstructive lung disease
E dey make breathing out dey hard becos d airways don tight or block, so d air go trap inside.
Examples na:
- COPD
- Asthma
- Bronchiectasis
- ππΎObstructive = air enter but e no fit comot well
• Restrictive lung disease
Dis on dey happen becos d lungs no dey open well either becos say e dey stiff or somethin dey compress am.
Examples:
- Pulmonary fibrosis
- ππΎRestrictive = air no even fit enter well
π‘If you go remember one thing e go be;
One na “air no fit comot” — the other na “air no fit enter” π«
π§ How you go know say e fit be dis condition?
• breathlessness
→ especially with small activity
• cough wey no wan go
→ chronic cough
• tiredness
→ body no get enough oxygen
ππ½ Symptoms fit start mild before dem worsen.
π§ Wetin you fit do by yourself or for house
• stop smoking
→ protect lungs
• avoid dusty environment
→ reduce irritation
• use medication as prescribed
→ improve breathing
ππ½ Small steps fit make big difference.
π§ Real life example
Person wey dey smoke for years…
At first, just small cough…
Later:
• breathing go begin dey hard
• walking short distance go tire am
ππ½ Na how chronic lung disease dey progress.
π§π©Ί When you gats go hospital π¨
• breathing hard even when u dey rest
• fever with cough
• lips turn blue or darker color
ππ½ These signs serious—no delay.
π’Final reassurance
Even though chronic lung disease no always curable…
ππ½ With proper care, you fit still live better and breathe easier.
π Reference
For full medical references, see English version of this article.
β οΈ Disclaimer
This article na for education only.
E no replace advice from doctor.
If breathing problem dey worry you, abeg see healthcare professional.
πRelated Health Topics
• Asthma
• COPD
• Cough
• Heart Disease
• Breathing Wahala
ππ½ If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version