Why I Dey Always Feel Tired? Wetin Fit Cause Am and When To See Doctor
Read in: English | Pidgin English
π Quick Breakdown
Everybody dey feel tired sometimes. But if person dey feel tired almost every day — even after e don sleep — e fit mean say something no balance for the body o. This kind tiredness fit affect body and mind together.
ππ½ Most times e get reason—and once you find am out, recovery godey easier.
This kind tiredness wey last long na dem dey call am fatigue.
π§ Wetin be fatigue?
Fatigue no be only sleepiness.
E fit feel like say:
• Body no get strength and everything dey feel heavy
• You no get motivation and e hard to focus
• You wake up but still feel tired
• You dey need rest everytime
If this kind tiredness dey affect your work, school, or daily life, e need check up.
π§ Common causes of fatigue
For many people, fatigue no dey come from serious illness.
Na everyday body and life factors dey cause am.
πΆPerson no sleep enough
If you no dey sleep well or your sleep pattern scatter, your body no go recover well.
Even if you sleep long, poor sleep quality fit still make you tired.
πΆStress and overthinking
Too much thinking, worry, or emotional stress fit make body dey use energy continuously.
πΆPoor diet
If you no dey chop balanced food or you dey skip meals, your body go lack important nutrients like Iron, vitamin B, and even protein.
Iron deficiency common well well — especially for women and children.
πΆPerson no drink enough water
If you no drink enough water, especially for hot weather, your body fit become weak, na dehydration dem dey call this one.
πΆAnemia (low blood)
This one common for women with especially with heavy period, pregnant women and pikin wey dey grow.
πΆInfection
Some infections fit make you feel tired for long: Malaria, Typhoid, Tuberculosis and other infection.
πΆHormonal problems
Hormones for our body dey control energy and body balance. If dem change, you fit feel tired e.g. thyroid problems.
πΆDiabetes
High blood sugar sometimes fit show as constant tiredness and low energy. E better to check o.
πΆLong-term illness
Conditions wey dey affect d heart, kidney and liver.
π§When e no serious
Fatigue no too serious if:
• e improve with rest
• e dey come dey go
• you no get other worrying symptoms
Most times, na lifestyle stress dey cause am.
π§π©ΊWhen to rush go hospitalπ¨
Go hospital immediately if tiredness come with:
• Chest pain
• Breathing problem
• Fainting
• Sudden weakness for one side
• Severe headache
• Confusion
π§ When to book appointment with doctor:
• Tiredness pass 2–3 weeks
• E dey worse over time and E disturb your daily life
Or if you get:
• Weight loss without reason
• Night sweats
• Hair loss
• Irregular period
• You dey feel sad everytime
No ignore long-time tiredness o!.
π§Wetin you fit do
If symptoms mild:
• Improve your sleep routine
• Chop balanced food (include protein and vegetables)
• Drink enough clean water
• Reduce stress
• Do small regular exercise
• Avoid too much alcohol
If e no improve, see healthcare professional.
π’Final message
Tiredness common.
But persistent tiredness no be something to ignore.
π Your body dey send signal.
Early check fit prevent bigger problem later.
βοΈπ₯ Related health topics
• Sleep Problems: Causes and Solutions
• Stress and Burnout: Signs and Recovery
• Anemia: Symptoms and Causes
• Depression: Symptoms and When to Seek Help
Medical references
• World Health Organization (WHO)
• Centers for Disease Control and Prevention (CDC) – Causes of Fatigue
• NHS – Persistent Tiredness
• American Academy of Family Physicians
Medical disclaimer
This article na for education only.
E no replace professional medical advice, diagnosis, or treatment. If you get symptoms wey worry you or e no improve, make sure say you talk to qualified healthcare professional.
← Check more symptoms for our symptom guideππΎ