Why You Dey Feel Weak and Tired:  Na Anemia?

Read in: English | Pidgin English

Published on February 19, 2026 at 11:52β€―PM

🩺 Medically reviewed by the Health Decoded Guide Editorial Team · Last reviewed: July 2026


πŸ” Quick Breakdown

If you dey feel tired, weak, or breathless, sometimes na anemia fit be the reason.

Anemia mean say your blood no dey carry enough oxygen round your body

πŸ‘‰πŸ½ When oxygen low, energy go drop


🟧 Wetin dey happen?

• anemia na condition wey happen when blood no get enough healthy red blood cells
• these blood cells dey carry oxygen go round the body
• if dem low, body no go function well


🟧 Why e dey happen

iron deficiency (na the most common cause)
→ body no get enough iron to make healthy red blood cells.

heavy menstrual bleeding
→ too much blood loss every month fit make iron level drop.

pregnancy
→ body need more iron to support both mama and baby.

vitamin B12 or folate deficiency
→ body no fit produce healthy red blood cells well.

• long-term illness (like kidney disease or some long-lasting infections)
→ some illnesses fit reduce how the body dey make red blood cells.

• blood loss (like stomach ulcer, internal bleeding or surgery)
→ losing blood fit reduce the number of red blood cells.

• genetic blood conditions (like sickle cell disease or thalassaemia)
→ some people inherit conditions wey affect how red blood cells form or survive.

πŸ‘‰πŸ½ Different things fit cause anaemia, but all of them reduce the blood ability to carry enough oxygen around the body.


🟧 Who e dey affect / How common e be

• women (especially with heavy period)
• pregnant women 
• children
• people wey no dey chop balanced diet

πŸ‘‰πŸ½ Anemia dey very common but people no too sabi


🟧 When e no be problem

• d anemia mild and you no get symptoms 
• body still dey cope well 
• you discover am early

πŸ‘‰πŸ½ Early stage fit no show clear signs


πŸ”Ά When you suppose take am serious 🚨

• tiredness no dey improve even after rest
you dey get breathing wahala  
dizziness 
 fainting
 
• you heart dey beat fast every now and then

πŸ‘‰πŸ½ If e dey affect your daily life, no ignore am


🟧 Signs to watch

tiredness wey no go
weakness
dizziness or light headedness
• pale skin or pale inside eyelid
shortness of breath
fast or strong heartbeat
headache

πŸ‘‰πŸ½ Some people just feel say dem “no strong like before”


🟧 Wetin you fit do by yourself

• go check your blood iron levels
• improve your diet (iron-rich food like vegetables, ugu, meat, liver, beans)
• follow your doctor advice

πŸ‘‰πŸ½ Treatment depend on wetin cause am—not just symptoms


🚨 When to see doctor 🩺

• tiredness no improve 
• you dey breathless easily
• your period too heavy
• you faint or nearly faint


🟧 Real life example

Ngozi notice say for some months, she dey always tired.

Even after sleeping well, she still no get energy.

If she climb small staircase, she go dey breathe fast.

She even begin think say maybe na because work too much.

When she finally go hospital, doctor ask about her heavy monthly periods and do blood test.

D result show say she get iron deficiency anemia.

After treatment, iron supplements and small changes to her diet, Ngozi begin feel stronger again over the next few weeks.

πŸ‘‰πŸ½ No every tiredness na stress. Sometimes, na anemia dey cause am, and simple blood test fit help find d problem.


🟒 Final reassurance

Anemia common—but e no suppose ignore am

With correct diagnosis, treatment dey work well

πŸ‘‰πŸ½ Understanding the cause na the first step


πŸ“š Reference

πŸ”ΆFor full medical references, check English version.


⚠️ Disclaimer

This article na for education only. E no replace doctor advice.

If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional


πŸ”— Related Health Topics

Iron deficiency
Heavy period
Fatigue
Endometriosis
Healthy Diet Basics
Test results explained

βœ¨πŸ‘‰πŸ½ If you want full explanation, read English version