Malaria: Early Signs and wetin Dem Mean

Read in: English | Pidgin English

Published on February 18, 2026 at 1:20β€―AM

🩺 Medically reviewed by thHealth Decoded Guide Editorial Team · Last reviewed: July 2026


πŸ” Quick Breakdown

Malaria na sickness wey infected mosquito bite dey cause, and e dey affect your blood.

E fit make person sick quickly, but if you treat am early, most people dey recover well.

πŸ‘‰πŸ½ If you understand the signs early, you go fit  act fast and avoid problem.


🟧 Wetin dey happen?

Malaria common for many African countries like Nigeria, Ghana, and Togo.

• mosquito bite na how e dey take spread
• na one specific mosquito (Anopheles) dey carry am

No be every mosquito bite dey cause malaria—but e better to avoid bites generally.


🟧 Why e dey happen?

• infected mosquito bite you
→ d parasite go enter your body through d mosquito bite

• d parasite dey usually go enter your liver first
→ e go multiply quietly

• den e go enter d blood, con dey attack your blood cells
→ e dey mostly destroy d red blood cells

 And na this destruction dey cause most of d symptoms.


🟧 How you go know say malaria don start?

• fever wey come suddenly
→ body temperature go just rise (your body temperature fit pass 38°C)
→ body dey fight infection

• chills and sweating
→ you go feel cold, then hot
→ parasite dey affect how body control temperature

• headache and body pain
→ general discomfort
→ inflammation and stress for d body

 Early malaria fit look like or start like flu or common cold—no ignore am o!

 You fit also read:


🟧 Wetin you fit do by yourself or for house

• go test early
→ to confirm if na malaria

• drink plenty water and other fluids
→ to support body

• rest well
→ as e help recovery

πŸ‘‰πŸ½ Every fever fit no be malaria o. Testing go help make sure say you receive d correct treatment.


🩺 When you suppose go hospital 🚨

• fever too high and no reduce (above 39°C)
• confusion or seizure
• you dey struggle to breathe

βœ¨πŸ‘‰πŸ½ These signs mean say malaria don become serious— abeg act fast.


🟧 How you fit prevent am

• sleep under insecticide-treated mosquito nets
→ to reduce mosquito bites

• use mosquito repellent spray
→ to protect d skin

• komot stagnant water around the house where mosquitoes dey like stay
→ stop mosquito breeding

• wear long-sleeved cloth if you dey outside for night

πŸ‘‰πŸ½ Prevention na your strongest protectionπŸ”₯.


🟧 Real life example

One rainy season in Kinshasa, Jean and him 8-year-old son David both begin feel sick.

At first, both of them get fever and small body pain.

Jean think say both of them get the same sickness.

But David fever begin rise quickly.

• e dey shiver well well
• e no fit chop
• e dey weak pass normal

Jean own symptoms no too serious.

Him get:

• body pain
• headache
• cough and blocked nose come later

When them reach hospital, healthcare workers test both of them.

D result show say:

David d pikin, get malaria.

• While Jean get flu (influenza).

Both of them receive different treatment and recover well.

πŸ‘‰πŸ½ No be every fever be malaria, and malaria no be the only sickness wey fit cause fever.

D best way to know wetin dey worry person na to get tested early.


🟒 Final reassurance

Malaria serious, but e dey treatable if you recognize the signs and start treatment early.

πŸ‘‰πŸ½ Understanding d symptoms fit help you act quickly and prevent serious complications.


πŸ“š Reference

For full medical references, see English version of this article.


⚠️ Disclaimer

This article na for education only. E no replace advice from doctor.

If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional.


πŸ”—Related Health Topics

Fever
Typhoid
Anemia
Headache
Dengue fever
Malaria Prevention
Malaria Treatment
• Malaria vs Typhoid: How to Tell the Difference.
Malaria vs Dengue fever: How to Tell the Difference

πŸ‘‰πŸ½ If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version