Common Cold: Signs, Causes and When to See Doctor
Read in: English | Pidgin English
π©ΊMedically reviewed by a licensed physician with over 10 years of clinical experience
π Quick Breakdown
Common cold na very common infection wey dey affect d nose and throat.
E no serious most times, and e go clear within few days.
ππ½ No be every sickness need strong medicine.
π§ Wetin dey happen?
Virus enter your body through nose or mouth.
• from person wey cough or sneeze
• from touching infected surface
ππ½ Once d virus enter, e go irritate your nose and throat.
π§ Wetin dey cause am?
• virus (especially dat rhinovirus)
→ main cause
• close contact
→ e dey spread easily
ππ½ Common cold fit happen anytime — even when d weather no too cold.
Why?
• Because no be d weather dey cause am — na d virus dey cause am
• D virus fit spread anytime people dey close together
• and for cold weather, people dey stay indoor more and dis go make d virus spread easier
ππ½ So no be cold weather dey cause cold — na virus, d weather just make am spread easier βοΈ
π§ How you go know say na common cold?
You go get dis symptoms:
• runny or blocked nose
• you go dey sneeze
• sore throat
• cough
ππ½ D symptoms dey start gradually.
π§ Other things/signs wey fit follow
• fever (many times no too high)
• headache
• body weakness
• tiredness
ππ½ all dis na sign say d body dey fight infection.
π§ Wetin you fit do by yourself or for house
• rest well
→ e go help d body recover
• drink water and warm tea
→to keep body hydrated
• use medicine for symptoms
→ to relieve discomfort
ππ½ No need for antibiotics o! e dey resolve efter somedays..
π§ Real life example
Person wake up with sore throat…
After 1–2 days:
• sneezing start
• nose begin run
ππ½ Na typical common cold pattern.
π§π©ΊWhen you gats go hospital π¨
• symptoms pass 10 days or constant fever pass 5 days
• high fever (d body temperature reach or pass 40 °C)
• breathing don dey hard
• severe headache
ππ½ E fit be another infection.
π’ Final reassurance
Common cold no serious most times.
ππ½ With rest and care, body go recover naturally efter some days.
π Reference
For full medical references, see English version of this article.
β οΈ Disclaimer
This article na for education only.
E no replace doctor advice.
If symptoms worsen or no improve, abeg see healthcare professional.
πRelated Health Topics
• Flu
• Pneumonia
• Fever
• Fever (Pikin)
• Ear infection
• Ear infection (Pikin)
• Sore throat
ππ½ If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version