When sweating too much—wetin your body dey try tell you
Read in: English | Pidgin English
π‘ Wetin dey happen for your body?
Sweating na normal way your body dey take cool himself.
• when body hot, you go sweat
• but sometimes e go dey too much or e come without reason as per even wen e no too hot
π That na when you need pay attention to our body.
π‘ Why e dey happen sef?
• heat or activity
→ body dey cool itself
• stress or anxiety
→ nerves dey activate sweat glands
• medical condition
→ infection, hormone problem, or others
π Body fit sweat for many reasons—not all be serious matter.
π‘ How you go know say e no dey normal?
• you dey sweat even when no hot
→ unusual pattern
• night sweats
→ wake up with for night with your cloth soaked with sweat
• sweating dey come with other symptoms
→ like weight loss or like your heart dey beat fast (palpitations)
π If pattern change, make you check am o!
π‘ Wetin you fit do by yourself or for house
• stay cool
→ avoid overheating, on AC, open widow but no let mosquitoπ¦ enter o..(use mosquito net)
• wear light clothing
→ e dey help reduce sweating
• manage stress
→ reduce nerve triggers
π These fit help mild cases.
π‘ When you gats go hospital π¨
• night sweats with weight loss
• sweating with chest pain
• persistent unexplained sweating
π These signs need proper medical evaluation.
π‘ Final reassurance
Sweating normal—but excessive sweating need attention.
π Early check fit help you understand the cause.
π Reference
For full medical references, see English version of this article.
β οΈ Disclaimer
This article na for education only.
E no replace advice from doctor.
If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional.
πRelated Health Topics
• Fever
• Anxiety
• Food Poisoning
• Unexplained Weightloss
π If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version