When your body dey slim down without reason
Read in: English | Pidgin English
π‘ Wetin dey happen?
You fit notice say your weight don dey reduce—your clothes dey loose for ur body—but you no change diet or exercise.
• sometimes your appetite go reduce
• sometimes sef you fit dey eat normal but still dey lose weight
π This kind change fit be like small tin at first, but e dey important to understand why.
π‘ Why e dey happen?
• when body dey use more energy
→ some conditions fit make metabolism increase
• your body no dey absorb food well
→ e go make your body no dey get full nutrients wey e need to function well
• stress or mood change
→ your appetite fit reduce and you quick notice am
π Weight loss no always come from one cause—sometimes na combination of different factors.
π‘ How you go know say e no dey normal?
• you loose weight without effort
→ no diet, no exercise, asper u no do anything at all to affect your weight willingly
• you dey feel weak or tired
→ body energy low
• other symptoms con join
→ like fever, night sweat, or body pain
π Even if e small, but e dey persistent u suppose go see doctor.
π‘ Wetin you fit do by yourself or for house
• track your weight
→ write am down, dey check every 3-4 days for like 2-3 weeks
• try maintain regular meals
→ e dey help support body
• try notice any other body changes
→ e dey useful for doctor to assess your condition
π Home observation good—but e no replace medical check at all o!
π‘ When you gats go hospital π¨
• weight loss fast or continuous
• weakness or constant tiredness/fatigue
• other symptoms like fever or pain
π Early check fit help detect the cause before e worse.
π‘ Final reassurance
Weight loss wey you fit explain how e happen, no always serious—but e always deserve medical check up.
π Checking early na smart move—no be fear.
π Reference
For full medical references, see English version of this article.
β οΈ Disclaimer
This article na for education only.
E no replace advice from doctor.
If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional.
πRelated Health Topics
• Fever
• Fatigue
• Chronic illness (Tuberculosis)
π If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version