Fever for pikin—No panic, but know when e serious!

 Pidgin English

Published on February 23, 2026 at 10:00β€―PM

🩺 Medically reviewed by the Health Decoded Guide Editorial Team· 
Last reviewed: July 2026


πŸ”Quick Breakdown

Fever for pikin common well-well, and most times na small infection dey cause am.

But some signs mean say you gats act fast!.

πŸ‘‰πŸ½ Wetin matter pass, na how d pikin dey behave, no be only d temperature o!


🟧 Wetin dey happen?

Fever for pikin na when body temperature rise pass normal (d body temperature reach or pass 38°C).

• d pikin body fit dey feel hot
• sometimes e go dey dull or sometimes restless

πŸ‘‰πŸ½ Na d body way of fighting infection.


🟧 Why e dey happen?

• Viral infections:
common cold
influenza (flu)
dengue fever

• Bacterial infections
ear infection
throat infection
urine infection
typhoid fever
  

• Others
Malaria
→ common in some areas depending on location

πŸ‘‰πŸ½ Most times na infection dey cause am.


🟧How you go know say d fever normal?

• low-grade fever (e no too high, temperature dey around 38°C)
• pikin still dey play, dey eat small small
• fever last less than 2–3 days
• no other serious symptoms

πŸ‘‰πŸΎ Most times, na body dey fight small infection.


🟧 How you go know say e no dey normal?

• very high fever (Temperature don dey pass 39°C dey near 40°C and above)

• pikin too weak or no responsive
→ no dey play or react

• e no fit drink or eat
→ d body dey struggle

• breathing hard or fast
→ dis one na serious sign!

πŸ‘‰πŸ½ Look the whole child—not just the thermometer o!.


🟧 Wetin you fit do by yourself or for house

• give d pikin enough fluid
→ e go prevent dehydration

• allow make d pikin rest
→ so d body go recover

• no overdress am o!
→ make d plenth cloth no trap d heat

πŸ‘‰πŸ½ Medicine like Paracetamol fit help give comfort—but no be cure!


🟧 Real life example

One evening, Tunde notice say Amara (him 4 year old daughter), dey feel warm and she no too dey active.

When dem check her temperature, e reach 38.3°C.

She still dey drink water, play small small and answer when people dey talk to her.

Her parents give am plenty fluids, allow am rest and continue to monitor am.

By d next day, d fever don reduce, and after two days she recover completely from wetin doctor later confirm say na viral infection.

No be every fever mean serious sickness but, wetin matter pass na how d person dey behave,

whether d pikin dey drink fluids well, and if any warning signs show.


🟧🩺 When you suppose go hospital 🚨

• pikin under 3 months with fever
• e get seizure/convulsion
• u notice say d pikin dey struggle to breath
• pikin no fit drink or no gree take fluid at all
• pikin dey too sleepy or hard to wake up

πŸ‘‰πŸ½ With dis signs you no suppose wait—go hospital immediately o!


🟒 Final reassurance

Fever for pikin common—and most times e go pass.

πŸ‘‰πŸ½ But if anything feel off, no hesitate to seek help.


πŸ“š Medical Reference

For full medical references, see English version of this article.


⚠️ Medical Disclaimer

This article na for education only. E no replace advice from doctor.

If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional.


πŸ”—Related Health Topics

Common Skin Rash Pikin
Malaria
Vomiting For Pikin
Ear Infection For Pikin
Sore throat
Typhoid Fever

πŸ‘‰πŸ½ If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version