Malaria: early signs and wetin e mean
Read in: English | Pidgin
Malaria na common infection for many African countries, like Nigeria, ghana, togo and many more.
Na mosquito bite dey transmit am. The kind mosquito wey dey cause na anopheles mosquito.
Malaria dey affect blood and fit make person feel sick fast.
Understanding the symptoms go help you act fast.
How malaria enter body
When infected mosquito bite person, parasite enter blood.
E dey go liver first.
Then e born plenty pikin wey go con go enter the blood again
and them go begin dey destroy the red blood cells.
This na wetin cause the symptoms.
Early malaria symptoms
Common symptoms include:
• fever
• chills
• headache
• tiredness
• body weakness
• sweating
• body pain
Symptoms fit start suddenly.
Dis symptoms fit look like flu or other infections when e dey start.
Learn more: Common Cold vs Malaria: How to Tell the Difference
For many tropical regions like Nigeria or ghana, malaria symptoms fit also resemble typhoid fever.
Learn more: Malaria vs Typhoid – How to Tell the Difference.
Why malaria dey cause weakness and fever
The red blood cells for our blood dey carry oxygen go round the body.
Malaria dey destroy these cells.
This go con reduce oxygen supply to the body.
This one go con cause:
• weakness
• dizziness
• fatigue
• fever
When malaria become serious
See doctor urgently if:
• fever high and no reduce
• serious weakness
• confusion
• breathing problem
• seizure
Early treatment dey very effective.
Prevention of Malaria
Person fit reduce the chance of getting malaria by avoiding mosquito bites.
The easy ways to prevent this malaria na to:
• sleep under insecticide-treated mosquito nets
• using mosquito repellent for skin/body
• wear long sleeves cloth or protective cloth for night
• komot stagnant water around the house where mosquitoes dey like and fit breed
For places where malaria common, early testing and treatment dey help prevent serious complications.
Important message
Malaria dey treatable.
Early testing and treatment dey important.
Understanding the symptoms go help protect your health.
Medical References
• World Health Organization (WHO)
• CDC
• American Heart Association / Relevant body
• Peer-reviewed clinical guidelines
Medical Disclaimer
This information na for education only. E no replace professional medical advice, diagnosis, or treatment. Always see qualified healthcare professional if you get symptoms or health concerns.