Virus Wey Rat Fit Spread: Wetin You Need Know About Hantavirus
Read in: English | Pidgin English
π©Ί Medically reviewed by licensed physicians with over 10 years of clinical experience
π Quick Breakdown: Wetin be Hantavirus ?
Hantavirus na rare infection wey people fit get from infected rats or dirty around d rat.
At first:
• e fit look like normal fever or flu (Influenza)
But later:
• breathing fit become serious problem.
ππΎ Hantavirus dey more common for some parts of Asia, Europe, and the Americas — especially places wey people fit come in contact with infected rats or rat dirty. Dem don find new cases for parts of Argentina and Chile.
π§ How e dey take start?
When person:
• clean place wey rat dirty
• and e inhale d dust from d rat urine or stool
D virus fit enter body through d air.
After some days:
• symptoms fit begin small small.
ππΎ Poor air circulation for d place dey increase d risk.
π§ Wetin fit cause am and how e dey spread?
• rat urine or drops from d rat
→ dey contain d virus
• sweeping dry dirty where rat don stay
→ d virus particles fit enter d air
• living for areas or places wey plenty rat dey
→ dey increase risk to get d infection
ππΎ Many people no know say dem fit get d infection wen dem clean d rat dirty.
π§ How you go know say e serious?
• breathing become hard
→ e mean say d lungs dey affected
• chest tightness: e go dey feel like say sometin dey press your chest
→ person fit get low oxygen problem
• dizziness or weakness serious
→ e mean say d body dey under stress
ππΎ Serious breathing symptoms need fast emergency care o!
π§ Wetin you fit do by yourself or for house
• no use your hand touch rat dirty, abeg use one time-use hand gloves and throw away am
→ to reduce exposure risk
• open d windows before cleaning
→ make breeze dey pass freely
• buy face mask, use am
→ to protect yourself
ππΎ No sweep or vacuum dry rat dirty directly because tiny particles fit spread for air.
π₯ Instead, spray d area gently with disinfectant or bleach-water mixture first,
allow am stay small, then use gloves and tissue or paper towel to clean d area carefully.
π§ Real life example (Simulation)
After opening old store room wey rats dey stay,
Mr Pedro wey dey leave for Patagonia for Argentina
E begin feel:
• fever
• body pain
• tiredness
after a few days:
• breathing begin dey hard am
For hospital:
• doctors suspect hantavirus infection after dem hear say e recently clean area wey rat dey
ππΎ E good to know if person don come in contact with rat or other infected people.
π§π©Ί When you suppose go hospital π¨
• difficulty breathing
• chest tightness
• serious weakness
• confusion
ππΎ all dis one fit mean serious lung involvement.
π’ Final reassurance
Hantavirus infection no common, but some cases wey dey serious fit worsen fast fast.
Avoid where rat dey plenty and abeg seek help early if you notice any symptoms to reduce complications later.
ππΎ Fever plus breathing problem after rat exposure no be sometin to ignore.
π Reference
For full medical references, see English version of this article.
β οΈ Disclaimer
This article na for education only.
E no replace advice from doctor.
If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional.
πRelated Health Topics
• Fever
• Shortness of Breath
• Common Cold
• Emergency Response Basics
• Covid 19
ππΎ If you still get questions or Prefer full medical detail? Read English version