Small Small Rash/Rough Skin (Keratosis Pilaris): Wetin E Be and How to Smooth Am

Read in: English | Pidgin English

🩺 Medically reviewed by licensed physicians with over 10 years of clinical experience


πŸ” Quick Breakdown

If your skin get small small rough bumps wey dey feel like you get goosebumps,
but e no dey disappear efter some minutes e fit be keratosis pilaris (short form: KP).

For many people e dey reduce with time, but e no dey disappear sharp sharp

πŸ‘‰πŸ½ E no be infection and e no dey dangerous
πŸ”₯ Dead skin no fall off as e suppose to, but instead e gather block d hair hole(hair follicle)


🟧 Wetin dey happen?

• keratosis pilaris na when small rough bumps show for skin
• e dey happen when dead skin block the small hair holes (follicles) for your skin
• E dey commonly show for d arm, thigh, and sometimes sef face and neck

πŸ‘‰πŸ½ E fit look like “chicken skin” or like permanent goosebumps


🟧 Why e dey happen

1️⃣ Skin shedding no smooth

  • Dead skin suppose fall off gently
  • For KP:
    • e stick together and instead of dem to fall off, dem block d hair opening 

2️⃣ Genetics play big role

  • Some people skin:
    • dey naturally thicker and e go increase the likelyhood to get this condition
  • Na why KP dey run for some families

3️⃣ Dry skin dey make am worse

  • When skin dry:
    • all those dead cells no fit shed well
  • and na why KP dey worse with:
    • cold weather and dry environments

4️⃣ Skin barrier slightly different

  • The outer skin layer:
    • no dey regulate itself perfectly
  • Result: keratin go accumulate

πŸ’‘ E no be dirty o!! and e no be infection—na how your skin dey behave.


🟧 Who e dey affect / How common e be

• mostly children and teenagers
• people with dry or sensitive skin
• people wey get eczema

πŸ‘‰πŸ½ E dey very common—many people get am


🟧 When e no be problem

• no pain
• no itching (or just small)
• skin just rough but nothing else

πŸ‘‰πŸ½ Na mostly cosmetic issue—as per na how e look, no be serious health problem. 
E dey important to sabi this difference
Many times doctors no go rush (prioritize) d matter.


πŸ”Ά When you suppose take am serious 🚨

• skin begin itch or irritate too much
• redness or swelling dey increase
• you no sure say na KP

πŸ‘‰πŸ½ If e change or worry you, make doctor check am


🟧 Wetin you fit do

πŸ’§ 1. Moisturize well (very important!)

• use thick cream everyday

πŸ‘‰πŸ½ This one alone fit make big difference


🧴 2. Use special creams

Look for creams wey get:
• urea
• lactic acid
• salicylic acid (ask for your local pharmacy)

πŸ‘‰πŸ½ Dem dey help smooth the skin


🚿 3. Dey gentle with your skin

• no scrub too hard
• avoid too much hot water

πŸ‘‰πŸ½ Too much scrubbing fit make am worse


πŸ§‘πŸΎ‍βš•οΈ 4. If e stubborn

• Sometimes doctor fit give stronger cream

πŸ‘‰πŸ½ Especially if e no improve


πŸ”ΆπŸ©Ί When to see doctor 🚨

• you no sure wetin the bumps be
• skin dey very red or painful
• treatments no dey work

πŸ‘‰πŸ½ Better to confirm am than guess


🟒 Final reassurance

Keratosis pilaris no dangerous
Na dead skin no fall off as e suppose to, so e gather block hair hole.

πŸ‘‰πŸ½ E fit improve with time (months to years)
πŸ‘‰πŸ½ Sometimes e no go fully disappear—but e go softer

πŸ”₯ Goal no be perfect skin o! —na smoother, comfortable skin


πŸ“š Reference

πŸ”ΆFor full medical references, check English version


⚠️ Disclaimer

This article na for education only.
E no replace doctor advice.
If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional


πŸ”— Related Health Topics

Eczema
Dry Skin
Pikin Skin Rashes
Allergies

βœ¨πŸ‘‰πŸ½ If you want, read English version