Fever for pikin—No panic, but know when e serious!
Read in: English | Pidgin English
π©ΊMedically reviewed by a licensed physician with over 10 years of clinical experience
π Quick Breakdown
Fever for pikin common well-well, and most times na small infection dey cause am.
But some signs mean say you gats act fast!.
β¨ππ½ Wetin matter pass, na how d pikin dey behave, no be only d temperature o!
π§ Wetin dey happen?
Fever for pikin na when body temperature rise pass normal (d body temperature reach or pass 38°C).
• d pikin body fit dey feel hot
• sometimes e go dey dull or sometimes restless
ππ½ Na d body way of fighting infection.
π§ Why e dey happen?
• Viral infections:
→ common cold
→ influenza (flu)
→dengue fever
• Bacterial infections
→ ear infection
→ throat infection
→ urine infection
→ typhoid fever
• Malaria
→ common in some areas depending on location
ππ½ Most times na infection dey cause am.
π§How you go know say d fever normal?
• low-grade fever (e no too high, temperature dey around 38°C)
• pikin still dey play, dey eat small small
• fever last less than 2–3 days
• no other serious symptoms
ππΎ Most times, na body dey fight small infection.
π§ How you go know say e no dey normal?
• very high fever (Temperature don dey pass 39°C dey near 40°C and above)
• pikin too weak or no responsive
→ no dey play or react
• e no fit drink or eat
→ d body dey struggle
• breathing hard or fast
→ dis one na serious sign!
ππ½ Look the whole child—not just the thermometer o!.
π§ Wetin you fit do by yourself or for house
• give d pikin enough fluid
→ e go prevent dehydration
• allow make d pikin rest
→ so d body go recover
• no overdress am o!
→ make d plenth cloth no trap d heat
ππ½ Medicine fit help give comfort—but no be cure!
π§π©Ί When you gats go hospital π¨
• pikin under 3 months with fever
• e get seizure/convulsion
• u notic say d pikin dey struggle to breath
ππ½ With dis signs you no suppose wait—go hospital immediately o!
π’ Final reassurance
Fever for pikin common—and most times e go pass.
ππ½ But if anything feel off, no hesitate to seek help.
π Medical Reference
For full medical references, see English version of this article.
β οΈ Medical Disclaimer
This article na for education only.
E no replace advice from doctor.
If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional.
πRelated Health Topics
• Common Skin Rash Pikin
• Malaria
• Vomiting For Pikin
• Ear Infection For Pikin
• Sore throat
ππ½ If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version