Swollen Lymph Nodes | Why D Glands Fit Swell
Read in: English | Pidgin English
Published on August 6, 2026 at 8:00 AM
π©Ί Medically reviewed by the Health Decoded Guide Editorial Team · Last reviewed: August 2026
π Quick Breakdown
Swollen lymph nodes na when d small glands wey help your body fight infection become bigger than normal.
Most times, na infection dey cause am and d swelling go reduce as your body recover.
But if d swelling no disappear or e dey get worse, e important make healthcare professional check am.
ππΎ Swollen lymph nodes usually mean say your immune system dey fight something.
π§ Wetin be lymph nodes and wetin e dey do?
Lymph nodes na small glands wey get beans shape wey dey all over your body.
• dem dey help trap germs before dem spread
• dem contain white blood cells wey dey fight infection
• dem plenty for d neck, armpit and d groin (around d private areas)
When your body dey fight infection, d lymph nodes fit swell because dem dey work harder.
π§ Wetin dey happen for your body?
• bacteria, virus or another problem fit trigger your immune system
• then d white blood cells go gather inside d lymph nodes
• d glands go come become bigger and sometimes sef, painful
As d infection dey improve, d swelling go usually begin reduce.
Na normal body defence process be this for many people.
π§ Why e dey happen?
• Common infections
- common cold
- sore throat
- ear infection
- tooth infection
- or skin infection fit make lymph nodes swell.
• Other medical conditions
→ some autoimmune diseases or medicines fit also cause d swelling.
• Rare causes
→ some cancers like lymphoma or leukaemia fit present with swollen lymph nodes.
Most lymph nodes wey swell up no be cancer. Infection na d most common reason or cause.
π§ Wetin you fit notice?
Early stage:
• small lump under d skin
• pain when you touch d area
• swelling for neck, armpit or groin (private area)
Later:
• fever if infection dey
• sore throat or other symptoms depending on d cause
• redness or warmth around d place wey swell up and this one dey common if d infection dey serious
π§ Wetin you fit do
• rest and drink enough fluids
• treat d infection if doctor identify one wey dey treatable
• use medicine for pain if healthcare professional recommend am
• no squeeze or press d swollen gland
• go do check up again if d swelling no reduce o
ππΎ D treatment depend on wetin cause d swelling, dem no dey treat only d swelling itself.
π§ Real life example
Chinedu get sore throat and fever for three days.
After like 4 days
• e notice one painful lump for d side of him neck
• e fear say maybe na cancer
When e visit clinic, doctor examine am and explain say d swollen lymph node dey happen because him body dey fight throat infection.
But d doctor explain say na virus infection dey cause am, so he recommend:
• rest and paracetamol if e get pain
• make e come back for follow-up
After about 3-4 weeks, d swelling disappear completely.
ππΎ Swollen lymph nodes fit dey scary, but most times na sign say your immune system dey protect you.
π§ π©Ί When you suppose go hospital π¨
• swollen gland no reduce after 2–4 weeks
• lump dey hard, no dey move or dey grow fast
• unexplained weight loss or night sweats
• difficulty breathing or swallowing
• swelling come with plenty pus or severe redness
ππΎ Early medical advice important.
π’ Final Reassurance
Most swollen lymph nodes no serious and dem dey improve once the infection clear.
ππΎ But if the swelling persist, continue to grow or come with other worrying symptoms, abeg make healthcare professional check am.
π Reference
For full medical references, see the English version of this article.
β οΈ Disclaimer
This article na for education only. E no replace doctor advice.
If you get swollen lymph nodes wey no dey improve or you get any worrying symptoms, abeg see healthcare professional.
π Related Health Topics
• Fever
• Sore Throat
• Mumps
• Tonsillitis
• Lymphoma (coming soon)
ππΎ If you still get questions or prefer full medical detail, read the English version.