When eating pattern no dey balanced again: E Fit Be Eating Disorder
Read in: English | Pidgin English
Published on April 15, 2026 at 10:40β―PM
π©Ί Medically reviewed by the Health Decoded Guide Editorial Team · Last reviewed: July 2026
π Quick Breakdown
Eating disorder no just be about food—na about how person dey think, feel, and control d way e chop.
E fit affect body and mind—but help dey available.
ππ½ No be lack of discipline—na deeper issue wey need understanding.
π§ Wetin dey happen?
Eating disorder no be just about food. E dey affect how person think about food, body shape and weight.
Some people fit:
• reduce how much dem dey chop
• eat plenty at once
• dey always worry about calories or body size
ππ½ As time dey go, relationship with food fit become unhealthy and difficult to control.
π§ Why e dey happen?
Different things fit contribute.
• pressure about body shape or appearance
→ person fit feel say e must look one particular way
• emotional stress
→ food fit become way to cope with difficult feelings
• need for control
→ some people fit use food to feel more in control of their life
ππ½ Food no be the real problem—na the emotional struggle behind am.
π§ How you go know say e no dey normal?
You fit notice:
• fear of eating or gaining weight
→ person dey avoid meals or certain foods
• eating without control
→ person feel say e no fit stop once e start
• guilt or shame after eating
→ even after normal meal, person fit feel bad
• body image no match reality
→ person still believe say e too fat even when people dey worried say e don lose too much weight
ππ½ These signs show say the relationship with food don become unhealthy.
π§ Wetin you fit do by yourself or for house
• talk to somebody wey you trust
→ no keep everything to yourself
• avoid blaming yourself
→ recovery take time
• find healthy ways to manage stress
→ like exercise, prayer, journaling or relaxation techniques instead of using food to cope
• seek professional help early
→ treatment dey work better when e start early
ππ½ Support from family, friends and healthcare professionals fit make big difference.
π§ Real life example
Amaka begin dey avoid eating lunch with her colleagues.
Any time dem invite am make dem chop together, she go always say:
"I don chop before." or "I no dey hungry"
After some weeks, one of her close friends notice say she no dey join dem again for lunch and she don lose small weight.
Later her closest friend ask am wetin dey happen.
Amaka laugh come say,
"Nothing oo. I just wan lose small weight. My goal na to reach 45 kg like before I born my first pikin."
Her friend shout,
"Jesus! Ahh, abeg oo! You go too small na!"
As d friend talk am, Amaka eyes begin water. Na then she realise say d matter don really affect am pass as she think.
Her friend comfort am and encourage am make she go see healthcare professionals.
After doctor evaluate am, dem discover say na eating disorder.
With counselling, nutrition support and support from people around am, she gradually begin build a healthier relationship with food.
ππ½ Sometimes na people wey know us well dey first notice say something don change. Early support fit make recovery easier.
π§π©Ί When you suppose go hospital π¨
• severe or fast weight loss or weight gain
• weakness, dizziness or fainting
• eating pattern don completely go out of control
• repeated vomiting or heart dey beat fast (palpitations)
ππ½ These signs fit mean say the body don begin suffer serious complications. No delay—abeg go see doctor immediately.
π’ Final reassurance
Eating disorder serious—but recovery dey possible.
ππ½ With the right help, person fit rebuild healthy relationship with food.
π Reference
For full medical references, see English version of this article.
β οΈ Disclaimer
This article na for education only. E no replace advice from doctor.
If you or person wey you know dey struggle, abeg seek help.
πRelated Health Topics
• Depression
• Anxiety
• Anxiety vs Panic attack
• Sleep problems
• Healthy Lifestyle and Weight Management
• Healthy Habits
• Healthy Diet Basics
ππ½ If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version