Stress Management: How to Calm Your Mind and Body
Read in: English | Pidgin English
π Quick Breakdown
Stress for this life na normal thing—but too much stress fit affect your body and mind.
Learning how to manage am go help you feel better and think clearly.
ππ½ No be to remove stress completely—na to control am.
π§ Wetin dey happen?
When you dey stressed:
• body go enter alert mode
• heart go dey beat faster
• mind go dey active
ππ½ E dey useful for short time—but e no good if e last long.
π§ Why e dey happen?
• work pressure
→ too many responsibilities
• personal issues
→ relationship or life changes
• worry about future
→ uncertainty
ππ½ Many small things fit add together make am big matter.
π§ How you go know say e don dey too much?
• you dey tired always
• you dey vex easily
• you no dey sleep well
ππ½ All dis ones na sign say d body dey overwhelmed/too stressed.
π§ Wetin you fit do by yourself or for house
• take deep breaths
→ to calm your body
• move your body (small exercise)
→ e go help release tension
• talk to another person
→ e go reduce d burden
ππ½ No keep everything inside, e no dey help anybody.
π§ Real life example
Person dey handle work stress (d oga dey stress am to finish projects),
family with e own pressure dey too ( dem never get pikin after only 6 months of marriage)…
After some time:
• sleep go scatter
• mood go change
ππ½ Na chronic stress.
π§π©ΊWhen you gats go hospital π¨
• stress no dey reduce
• anxiety too much
• you dey feel overwhelmed/uncomfortable/too stressed every time
ππ½ You fit need professional support.
π’ Final reassurance
Stress common—but e dey manageable.
ππ½ Small daily steps fit restore balance to your life.
π Reference
For full medical references, see English version of this article.
β οΈ Disclaimer
This article na for education only.
E no replace doctor advice.
If stress dey affect your health, abeg see healthcare professional.
πRelated Health Topics
• Sleep problems
• Anxiety
• Depression
• Chronic fatigue Syndrome
• Headache
ππ½ If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version