When fat for blood don too much—High Blood Cholesterol

Read in: English | Pidgin English

Published on April 16, 2026 at 11:20β€―PM

🩺 Medically reviewed by the Health Decoded Guide Editorial Team · Last reviewed: July 2026


πŸ” Quick Breakdown

High cholesterol na when fat for your blood don too much.

You no go feel am—but e fit cause heart problem later.

πŸ‘‰πŸ½ Na silent condition wey dey build slowly.


🟧 Wetin dey happen?

Cholesterol dey your blood normally.

• but when e too much
• e begin to stick for blood vessels

πŸ‘‰πŸ½ This go reduce how blood dey flow.


🟧 Why e dey happen?

• food wey get too much fat

Foods wey get plenty fat include  all those fry fry sweet small chops (puff-puff, buns, akara), fried meat, oily soup (like egusi, ogbono), and even meat wey get plenty fat.

πŸ‘‰πŸΎ No be only d food matter — d oil quality, portion size, and how often you dey chop am matter too

→ increase cholesterol

• no exercise
→ body no dey burn fat

• family history
→ some people inherit am

πŸ‘‰πŸ½ Both lifestyle and genetics matter.


🟧 How you go know say u get high cholesterol?

• no clear symptoms
→ most people no go notice am early

• only blood test fit show am
→ routine check important

πŸ‘‰πŸ½ Many people dey find out late especially if dem no check because many people no dey get any symptom.


🟧 Wetin you fit do by yourself or for house

• reduce fatty and processed food
→ e go protect d blood vessels

• exercise regularly start small small
→ even 10- 20 mins per day fit improve balance

• follow doctor advice
→ manage risk

πŸ‘‰πŸ½ Small changes fit reduce big risk.


🟧 Real life example

Uncle Emeka no get any pain.

E no dey feel sick.

In fact, e think say everything dey okay.

One day, during routine medical check-up, doctor do blood test.

Na there dem discover say e get high cholesterol level.

Doctor explain say if dem no discover am early, e fit quietly increase e risk of heart attack or stroke.

πŸ‘‰πŸ½ High cholesterol often dey silent, so routine blood tests fit help discover am before complications happen.

🟧 🩺When you suppose go hospital 🚨

chest pain
sudden breathlessness
dizziness with weakness

πŸ‘‰πŸ½ These signs fit mean say complication don start.


🟒Final reassurance

High cholesterol common—but e dey manageable.

πŸ‘‰πŸ½ Once you take control early, you fit protect your heart long-term.


πŸ“š Reference

For full medical references, see English version of this article.


⚠️ Disclaimer

This article na for education only.
E no replace advice from doctor.
If you get concern, abeg see healthcare professional.


πŸ”—Related Health Topics

Heart disease
High blood pressure
High blood sugar
Stroke

πŸ‘‰πŸ½ If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version