HIV no be end!—understand am early
Read in: English | Pidgin English
π Quick Breakdown
HIV na virus wey attack d body defense system.
But with treatment, person fit live normal, healthy life.
ππ½ Early testing na the most important stepπ₯.
π§ Wetin dey happen?
Wen person catch HIV: D virus go enter d blood and e go begin dey attack d immune system.
• e go reduce d body power to fight infection
• and over time, d body go weaken if you no treat am
ππ½ But this process slow—and na y e dey take some time to show for body but na d same d reason y if person treat am early, e fit live normal healthy life.
π§ How e dey spread?
1οΈβ£HIV dey pass mainly through body fluids when person have sex without condom.
These body fluids na:
- blood
- semen (man sperm)
- vaginal fluid (woman wetness)
ππ½ If person get HIV, the virus dey inside these fluids.
π How e take happen?
During sex without condom:
- man fluid go enter woman body
- woman fluid go enter man body
Inside body, small small openings dey (as per normal thing)
ππ½ Na through dis small openings d virus go fit pass enter d blood
π‘ Real-life example
πΆ Example 1:
Man and woman sleep together without condom
→ man release inside
→ if man get HIV, virus fit enter woman body
πΆ Example 2:
Woman get HIV but she no know
→ during sex, her fluid touch the man
→ virus fit enter d man body
πΆ Example 3:
Person fit look healthy/normal
→ but still get HIV
ππ½ You no fit know by how person be or look
β οΈ Important to know!
HIV no dey pass through:
- hugging
- sharing food
- handshake
ππ½ Na mainly through body fluids during unprotected sex
π‘ Simple takeaway
ππ½ No condom = fluids mix
ππ½ Fluids mix = HIV fit pass
2οΈβ£ Blood Contact
HIV fit also pass when infected blood enter another person body.
ππ½ This one dey happen when people share things wey fit cut skin.
π How e take happen
If infected blood touch:
- open wound
- fresh cut
- inside body
ππ½ virus fit enter blood
π‘ Real-life example
πΆ Example 1:
Two people dey share needle (like for injection or drug use)
→ if one person get HIV
→ blood fit remain for the needle
→ virus fit enter the next person body
πΆ Example 2:
Using same sharp object like:
- razor blade
- knife
- local tattoo needle/tools
→ if dem no clean am well
→ infected blood fit transfer to another person
β οΈ Important to know
ππ½ Even small blood wey you no see well fit still carry virus. Always use clean or new sharp tins/objects
3οΈβ£ Mother to Child
HIV fit pass from mother to baby.
π When e fit happen
During:
- pregnancy
- childbirth (wen d baby dey comot from d mama body)
- breastfeeding
π‘ Real-life example
πΆ Woman get HIV and she no know
→ she carry belle
→ virus fit pass enter d baby
β οΈ Good news dey!!!
ππ½ If person detect HIV early:
- doctor fit give treatment
- e go reduce d chance for d baby to get am
ππ½ Nowadays many babies no dey catch HIV if d mama recieve proper care dey
π’Simple takeaway
- Avoid sharing sharp objects
- Test early, especially for pregnancy
- Treatment fit protect both mama and d pikin o!
π§ How u fit sabi say person get am?
• early stage fit look like flu
→ fever, sore throat
• later, person go dey fall sick often
→ immune system don weaken
• weight loss or night sweat
→ dis one advanced stage signs
ππ½ Some people no dey get symptoms early—Na why testing dey important!.
π§ Wetin you fit do by yourself or for house
• go for testing
→ know your status!
• practice safe sex (wear condom, ask partner status before hand)
→ prevent spread
• take medication if u get am
→ e go help control virus
ππ½ Treatment dey effective if you follow am well.
π§ When you gats go hospital π¨
• frequent infections
• severe weight loss
• persistent fever
ππ½ These signs mean say immune system don weak.
π’Final reassurance
HIV today no be death sentence.
ππ½ With treatment, people dey live long, full life.
π Reference
For full medical references, see English version of this article.
β οΈ Disclaimer
This article na for education only.
E no replace advice from doctor.
If you get concern about HIV, abeg see healthcare professional.
πRelated Health Topics
• Sexually Transmitted Infection (STI)
• Tuberculosis
• Unexplained Weight loss
• Night sweats
• Fever
ππ½ If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version