When your belle dey behave somehow—understanding IBS
Read in: English | Pidgin English
π‘ Wetin dey happen?
IBS na condition wey dey affect how your belle and intestine dey work.
• Sometimes your belle fit dey pain you
• And toilet pattern fit change—sometimes person go get loose stool, sometimes e go hard
π Even if person do test and e dey normal,d symptoms dey uncomfortable.
π‘ Why e dey happen?
• d intestines dey too sensitive
→ e go make normal digestion feel uncomfortable
• stress or emotion
→ d brain and d intestine dey connected; if person dey stressed, e go affect the brain wey go con later affect how d intestine go react
• certain foods
→ some food fit trigger d symptoms
π IBS no be one single cause—na combination, but person fit learn how him belle dey work or how e dey react to different condition/stress and food.
π‘ How you go know say e no dey normal?
• You get pain for belle wey dey come and go
→ not just once
• you dey bloated every times
→ belly full or tight
• you dey get mixed stool pattern
→ sometimes your stool dey loose (diarrhea) and sometimes e dey hard (constipation)
π If e dey repeat, e fit be IBS—but still check am 1st to make sure na really IBS.
π‘ Wetin you fit do by yourself or for house
• identify trigger those foods
→ try avoid all those food wey dey make d symptoms worse
• manage stress
→ e dey helps reduce flare-ups
• adjust fiber intake
→ depending on your pattern
π IBS control na personal journey.
π‘ When you gats go hospital π¨
• if u see blood for your stool
• weight loss
• severe or worsening symptoms
π These signs no be IBS—e need proper check up.
π‘ Final reassurance
IBS common—and e manageable with time.
π Once you understand your body, symptoms go dey easier to control.
π Reference
For full medical references, see English version of this article.
β οΈ Disclaimer
This article na for education only.
E no replace advice from doctor.
If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional o!
πRelated Health Topics
• Bloating
• Constipation
• Diarrhea
• Food poisoning
• Vomiting
π If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version