Lower Belly Pain: Wetin Your Body Dey Try Tell You
Read in: English | Pidgin English
π‘ Wetin dey happen for around you private area?
Pelvic pain na pain wey you feel for lower part of your belly — around where womb, bladder, and intestine dey.
E fit be:
• sharp and sudden
• or dull pain wey dey stay for long like weeks and months
π No be only period dey cause am — different organs wey dey around dat area fit dey involved
π‘ Why e dey happen?
• Period pain/cramps
→ womb dey contract to shed lining wey dey led to mentration
• Infection
→ bacteria fit irritate inside body of any of those organs around the private area
• Ovarian cyst or other conditions
→ swelling or pressure fron the ovaries fit cause pain
π Sometimes sef, na combination of things dey cause the pain
π‘ How you go know say e no dey normal?
• pain wey too strong and e happen suddenly without any injury
→ especially if e shock youπ
• pain with fever or vomiting
→ body dey show sign of infection
• bleeding wey no normal
→ e different from your usual period
π No panic — but make you check am early
π‘ Wetin you fit do by yourself or for house
• rest and use mild pain relief
→ e dey help if na simple pain/cramps
• warm compress for lower belly
→ dat one go relax d muscles and reduce pain
π If pain no improve, no continue to wait o begin dey find way go hospital make doctor check am!
π‘ When you gats go hospital sharperly? π¨
• sudden severe pain
• you feel faint or weak
• fever with pelvic pain
π These ones need quick medical attention — no delay!
π‘ Final reassurance
Pelvic pain common, but your body no dey send signal for nothing.
π Listen to am early — e go help you avoid bigger issues
π Reference (Pidgin version)
For full medical references, see English version of this article.
β οΈ Disclaimer (Pidgin version)
This article na for education only.
E no replace advice from doctor.
If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional.
πRelated Health Topics.
• Menstrual cycle
• Vaginal infections
• Hormonal imbalance
π If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version