Lower Belly Pain: Wetin Your Body Dey Try Tell You

Read in: English | Pidgin English

🟑 Wetin dey happen for around you private area?

Pelvic pain na pain wey you feel for lower part of your belly — around where womb, bladder, and intestine dey.

E fit be:

• sharp and sudden
• or dull pain wey dey stay for long like weeks and months

πŸ‘‰ No be only period dey cause am — different organs wey dey around dat area fit dey involved


🟑 Why e dey happen?

• Period pain/cramps
→ womb dey contract to shed lining wey dey led to mentration

• Infection
→ bacteria fit irritate inside body of any of those organs around the private area

• Ovarian cyst or other conditions
→ swelling or pressure fron the ovaries fit cause pain

πŸ‘‰ Sometimes sef, na combination of things dey cause the pain


🟑 How you go know say e no dey normal?

• pain wey too strong and e happen suddenly without any injury
→ especially if e shock youπŸ‘€ 

• pain with fever or vomiting
→ body dey show sign of infection

• bleeding wey no normal
→ e different from your usual period

πŸ‘‰ No panic — but make you check am early


🟑 Wetin you fit do by yourself or for house

• rest and use mild pain relief
→ e dey help if na simple pain/cramps

• warm compress for lower belly
→ dat one go relax d muscles and reduce pain

πŸ‘‰ If pain no improve, no continue to wait o begin dey find way go hospital make doctor check am!


🟑 When you gats go hospital sharperly? 🚨

• sudden severe pain
• you feel faint or weak
• fever with pelvic pain

πŸ‘‰ These ones need quick medical attention — no delay!


🟑 Final reassurance

Pelvic pain common, but your body no dey send signal for nothing.

πŸ‘‰ Listen to am early — e go help you avoid bigger issues


πŸ“š Reference (Pidgin version)

For full medical references, see English version of this article.


⚠️ Disclaimer (Pidgin version)

This article na for education only.
E no replace advice from doctor.
If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional.


πŸ”—Related Health Topics.

• Menstrual cycle
Vaginal infections
Hormonal imbalance

πŸ‘‰ If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version