Heavy Period: Why My Menstrual Bleeding Too Much?

Read in: English | Pidgin


πŸ”Ž Quick Summary
Heavy period mean say your monthly bleeding too much or e dey last too long. E common, but you no suppose ignore am because e fit cause low blood, weakness, and even affect your daily life.


1️⃣ Introduction

Heavy menstrual bleeding (menorrhagia) mean say period too heavy or too long.

Flow no dey same for everybody, but too much bleeding no normal.


2️⃣ Wetin be heavy bleeding?

We dey call am heavy bleeding if:

• You dey change pad or tampon every 1–2 hours
• Period last pass 7 days
• You see big or like thick blood clots
• You dey wake up for night to change pad
• You dey feel weak or dizzy


3️⃣ Common causes

Different things fit cause heavy period:

 

• Hormonal imbalance

If ovulation no regular, womb lining go too thick.

When e shed, bleeding go plenty.

 

• Fibroids

Non-cancer growth for womb, (tumor wey no be cancer).

E fit cause heavy bleeding and pressure.

 

• Adenomyosis

This wan na when womb lining wey dey leading to that menstraul bleedind start to dey grow enter muscle.

 

• Bleeding problems

Blood no clot well.

 

• Pregnancy-related causes

Bleeding for pregnancy no normal — check hospital fast.

 


4️⃣ Why e matter

Heavy bleeding fit cause:

Low blood/anemia
Tiredness
Dizziness


5️⃣ When to see doctor

• Bleeding too much
• Weakness
• Big clots
• Pain


6️⃣ When e urgent

• Fainting
• Severe weakness
• Continuous heavy bleeding


7️⃣ Treatment

Depend on cause:

• Iron
• Hormone drugs
• Other treatment


8️⃣ Final message

No ignore heavy period.

Check am early.


 Related health topics

Irregular Periods: 
Hormonal Imbalance
• Iron Deficiency: 
• Pelvic Pain: 


Medical References

• World Health Organization – Menstrual Health Guidelines
• American College of Obstetricians and Gynecologists (ACOG)
• Peer-reviewed gynecology guidelines


Medical Disclaimer

This article na for education purpose only. E no replace medical advice from qualified health professional. Always talk to doctor or trained health worker about your health concerns.