Your Monthly Cycle: Wetin Your Body Dey Do Every Month
Read in: English | Pidgin English
π‘ Wetin dey happen for inside woman body?
Every month, your body dey prepare in case pregnancy wan happen.
If pregnancy no con happen:
• the lining inside your womb go shed, asper e go breakdown
• na that on be the bleeding wey you dey see as period
π Na normal body process — no be sickness
π‘ Why e dey happen?
• Na hormones from brain
→ dey control when ovary go release egg
• These hormonses estrogen and progesterone
→ dem dey regulate the building and later breakdown of the womb lining
• If woman go carry belle that is no pregnancy
→ the body go reset and start again
π Your body dey follow a rhythm — we fit call am "monthly reset"
π‘ How you go know say e no dey normal?
• your period too heavy that is you dey bleed too much or e too painful
→ e fit affect your daily life
• cycle dey change every time
→ no pattern at all (irregular period)
• no period for months
→ especially if no pregnancy (missed period)
π Some changes normal, but pattern wey dey repeat need attention
π‘ Wetin you fit do by yourself or for house
• Track your cycle, you dey mark am for calender
→ e go help you understand your pattern
• Eat well and manage stress
→ e supports hormone balance
π Knowing your cycle fit help you plan and avoid surprise, so you go dey event for example con dey bleed
π‘ When you gats go hospital π¨
• when heavy bleeding no wan stop
• you get severe pain wey you no fit handle, u dey lie down no fit do anything cos the pain or u dey vomit
• you no see period for months
π No fear — but make doctor check am early
π‘ Final reassurance
Your menstrual cycle na important part of your health.
π The more you understand am, the more control you get over your body
π Reference
For full medical references, see English version of this article.
β οΈ Disclaimer
This article na for education only.
E no replace advice from doctor.
If symptoms serious or no go, abeg see healthcare professional.
πRelated Health Topics.
• Vaginal infections
• Hormonal imbalance
• Pelvic pain
π If you still get questions or prefer full medical detail? Read English version